Liam Payne leave £24m fortune but no will - Why im ex go co-administer im estate

Wia dis foto come from, Getty Images
Liam Payne leave behind money, property and possession wey worth more dan £24m wen im die last year, official record show.
Di One Direction singer die at di age of 31 for Argentina for October last year witout making any will.
If pesin die without making will, di rule be say any pikin go normally inherit im everytin wey im get if e no get any living husband, wife or civil partner.
Payne no ever marry but im and former Girls Aloud singer Cheryl get one son, Bear, wey now dey eight years old.
Cheryl, wey be Payne former partner for more dan two years, and music industry lawyer Richard Bray na dem dem name as administrators of im estate.
Dem go fit manage di money, but for now, dem no get enough authority to distribute.
For February, one court for Argentina bin drop charges of criminal negligence against three pipo out of five wey dem bin charge in connection wit Payne death.
Im death shock di music world and millions of fans of One Direction, one of di most successful pop groups of di 2010s.
Probate documents show say di total gross value of im estate be £28.6m initially, but e reduce to £24.3m wen dem deduct debts and expenses.
Court give limited representation to Cheryl and Bray wey e describe say na "to allow di administrator power to preserve di dead man estate until dem make general grant".









