Six ways to protect your kidney

How to keep your kidney safe

Wia dis foto come from, Getty Images

    • Author, Komla Adom
    • Role, Senior Reporter
    • Reporting from, Acccra

Your kidney na very important organ for body.

Im dey make urine, wia im dey remove waste inside pesin im blood.

Di kidney, according to di international society of Nephrology, don also dey help control blood pressure and maintain chemical balance.

Im dey help make pesin im red blood cells, na so im dey critical.

But ova time, many pipo don dey suffer from kidney failure and oda disease wey dem dey call non-communicable disease.

Sabi pipo for medicine don tok say di rate pipo don dey get kidney disease for sub-Saharan Africa na alarming.

Na so pesin for spend plenty moni for treatment and dialysis.

Di annual cost for kidney treatment averagely for Africa na between $13k - $25k, according to findings of di society of nephrology.

Di pipo wey dey suffer dis disease don dey relay on dialysis at least two times a week, to survive.

Wetin di dialyses dey do be say, im dey remove waste product and excess fluid inside pesin blood, because di kidney wia for do dat job, neva dey function anymore.

Dem also tok say chronic kidney disease na health priority for 49 percent of kontries for Africa for 2023.

Dem also find say pipo dey pay plenti money for treatment for kidney disease.

If you no get money, na Wahala for you, sake of many kontris neva dey absorb treatment.

Among di old and di young, kidney disease don dey kill pesin.

Na so ogbonge groups like di international federation of kidney foundations and international society of nephrology don carry di world kidney day initiative come.

Dis na global campaign to “raise awareness of di importance of pesin im kidneys to reduce disease.”

As di world don dey mark di day on 14 March, sabi pipo dey teach we how we go fit protect our kidneys.

Six tins you fit do to protect your kidneys

Dr Michael Baah Biney wey be medical doctor and health advocate for Ghana, say make every pesin do dis few tins.

Stay well hydrated thru di day

Wit about 8 cups of standard drinking water per day, pesin go fit protect im kidney, especially for pipo wit higher risk like pesin wey get diabetes, hypertension, sickle cell disease.

Na pesin wey don undergo recent invasive surgery like Caesarian section for also drink plenty water.

Reduce alcohol, stop smoking.

Dis na critical tin pesin for do to keep dia kidney healthy. Alcohol and smoke be enemy of di kidney.

Verify herbal preparations bifor you go take am

You for check weight-loss and trimming medicine wia pipo don dey advertise for social media, bifor you go take dem.

You fit ask your doctor about dis medicine.

Reduce abuse of pain killers and oda medicine

Some of dis medicine get product wia go fit destroy your organs, especially di kidneys.

Wetin you for do be say, seek medical advice.

Neva buy medicine for street.

Do abdominal ultrasound

Anoda tin every pesin gatz to do, be say you for do wetin dem dey call “abdominal ultrasound”.

Sabi pipo say you for do am at least once every ten years.

But pesin fit do am once every two to five years.

Dis process don dey check di health of pesin kidneys and oda organs.

Check your blood pressure

Na pesin wia get hypertension wey chop less dan 40 years, dis tips na sometin you gatz take seriously.

High blood pressure be early sign of silent and early kidney wahala.

Make una dey remember, “happy kidney na happy life.”