For di first time in history US court find parent of boy wey do school shooting guilty of manslaughter

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Madeline Halpert & Lisa Lambert
- Role, BBC News
Jury don find one Michigan mama guilty for involuntary manslaughter say she no stop her pikin from carrying out one deadly school shooting.
45-year-old Jennifer Crumbley na di first American parent wey go dey convicted of manslaughter sake of di mass shooting wey dia pikin do.
Prosecutors accuse am say she dey negligent because she allow her son to get gun and no gree torchlight di warning signs.
Her husband, James dey face separate trial on di same charges wia im don plead not guilty.
Dia son wey be 17 dey face life in prison sake of say im kill four classmates for Oxford High School for Michigan for 30 November 2021.
Seven pipo bin also dey injured for di shooting.
Di judge tell di jurors say dis go fit be "di hardest tin you don eva do".
Ms Crumbley no show emotions and continue to dey look down as dem read di ruling for Oakland County court for Tuesday.
End of Di one wey oda users dey read well well
She bin dey charged for four involuntary manslaughters, and each of dem get jail time of almost 15 years.
Some of di family members of di pipo wey die for di shooting dey happy ova di verdict.
Buck Myre wey be di papa of 16-year-old Tate Myre wey die for di shooting tell BBC for statement say, "di pipo don tok! You fit gree or disagree with di pipo but dis na how di system suppose work."

Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin be di koko of di trial na weda di mama suppose don prevent di deadly crime.
Ms Crumbley and her husband bin buy dia son di gun few days before di shooting.
Police charge dem within days of di killing. Police bin find di couple reach one industrial building for Detroit afta di public give dem tip.
Dem bin dey for county jail for ova two years because dem bin no fit make bail.
At first, dem suppose try di parents togeda until November wen dem ask for separate trials. Oga James Crumbley trial go start for March.
For her trial, prosecutor present evidence say Ethan Crumbley bin want mental health help and bin don dey complain of hallucination but im parents no get am treatment.
Ms Crumbley tok for stand say she bin no tink say her son bin get mental health palava.
Di morning wey di shooting happun, di parents bin cut short one school meeting wia dem suppose discuss one drawing cause concern wey dia pikin draw. Dem bin say dem get work and no fit carry dia den 15-year-old pikin go back house.
School officials send am go back class without say dem check im schoolbag wey get gun inside.
Hours afta dis meeting, na im Ethan kill Juliana, 14, Myre, 16, and Madisyn Baldwin and Justin Shilling, both 17.
Parents of mass shooters fit dey liable for dia pikin crimes?
Some sabi pipo tink say di case against di Crumbleys fit lead to more charges for parents dem wey be say dia pikin commit mass shooting.
Howeva one Professor of Law and Psychiatry for di University of Pennsyvania, Stephen J Morse don disagree with di ruling say na Ethan Crumbley plead guilty and na only am get hand for di shooting.
E say, "I get say she no be di best mama for di world, but dat one no be crime."
Oga Morse say di decision go set bad precedent wey be say di courts go come dey find "scapegoats" for dis kain mata.
Oda pipo say dis case dey so unusual e no dey likely say e go impact oda type of cases.
Frank Vendervort wey be University of Michigan clinical professor of law tok say, "I no dey fear say e go widen di gates so dat parents go dey charged for every kain case, if dat kain tin dey. I tink di facts of dis case dey so unique and dey kind of extreme."

Wia dis foto come from, Getty Images
Prosecutors try make di same case for di two week trial say Ms Crumbley no ansa her pikin wey bin dey beg for help even afta she bin dey worry ova am insdide her private messages.
Dem show messages wey Ms Crumbley bin send to man wey she bin dey get affiar with outside her marriage wia she tok before she go di school meeting say she dey fear say her pikin go do "something dumb".
Wen she climb di stand for her defence for di trial, Ms Crumbley bin try blame her husband for di gun dem buy dia pikin.
She tell jurors say na her husband carry dia son go gun shop one day afta Thanksgiving to buy am di gun as gift.
She say, she bin no feel comfortable to dey responsible for securing di gun and leave dat work to her husband.
Ethan Crumbley no take di stand because dem bin expect am to invoke di fifth amendment and refuse to testify.
Families of di victims dey vex say school officials no face di same legal kasala as di shooters parents.
One independent investigation wey comot last year show plenti failures from di school wey include to allow Ethan go back class without say dem check im bag.
Di school district don promise to review and improve dia practices and policies sake of di report.












