Why SSANU, NASU dey embark on a total and indefinite strike

Members of SSANU/NASU during dia one-day peaceful protest in July 2024
Wetin we call dis foto, Members of SSANU/NASU bin do a one-day peaceful protest for July 2024 sake of di salaries wey goment dey owe dem
Read am in 4 mins

Di Senior Staff Association of Nigerian Universities (SSANU) and the Non-Academic Staff Union of Educational and Associated Institutions (NASU) don declare total and indefinite strike for all di state and federal universities for Nigeria.

Dis action go start well-well on Tuesday, October 29, 2024, according to Mr Frankilin Duru wey be one of di leaders of SSANU for di Federal University of Technology Owerri (FUTO).

"E go be a total withdrawal of our services across all di universities for Nigeria, both from di office of Vice Chancellor, di office of di Registrar, for student affairs, and evriwia," oga Duru tok.

According to am, di national excos of SSANU and NASU direct dem to hold a chapter congress dis Monday for all dia chapters to inform dia members of di strike and cut dem warning say evribodi must to comply, "den di main strike go start tomorrow".

For March dis year, members of SSANU and NASU bin don do warning strike wey last for seven days, to take demand beta treatment from di goment.

Also in July, dem do peaceful protest for all di universities, asking goment to treat dem di same way dem dey treat di Academic Staff Union of Universities (ASUU).

Dia vex be say afta all di unions for Nigeria public universities bin go strike for eight months under former President Muhammadu Buhari, di federal goment later pay ASUU four months arrears of dia salary for dat period, but dem no pay SSANU and NASU.

"We don write plenty times to di ministries wey dey involved but up till now, we neva receive dat salaries," oga Duru tok.

E also mention say no non-teaching staff dey for di reconstituted committee wey goment bin set up for di welfare of University workers. So e follow for wetin dem dey agitate for.

Anoda demand wey SSANU and NASU dey make na for di release of dia earned allowances ova di years wey goment still neva pay dem.

During di warning strike for March, Nurudeen Taiye Yusuf, di chairman of Ssanu for di University of Abuja, tell BBC Pidgin say dem no dey happy wit di "discriminatory treatment" wey goment dey give to dem.

"Our work dey as important as di Asuu members. If we no dey, water no go run for di universities, light no go dey, security no go dey, di environment no go clean. So how professor go flush im toilet if water no dey run? How students go dey secure for dia hostels if security pipo no work? Who go run di university clinic if pesin fall sick?" Oga Yusuf tok.

"Goment no suppose dey treat us as second-class pipo, we get professionals among us and our work matter. Na all of us follow go strike in 2022, how e be say na one set of pipo goment pay and leave di odas?"

Members of SSANU and NASU include nurses wey dey work for university clinics, accountants wey dey for di bursary department, clerks for di registrar and administrative departments, electrical, drivers, mechanical and water engineers wey dey make sure say electricity, and water dey available for di universities.