England qualify for dia first ever final for Fifa Women’s World Cup

Ebgland vs Australia

Wia dis foto come from, Getty

England spoil co-hosts Australia party by booking dia place in di Women's World Cup final for di first time on a historic evening for Sydney.

Silencing a sell-out crowd at Stadium Australia, di Lionesses become di first English side since 1966 to reach di final on di world stage.

Dem cap a sensational two years under manager Sarina Wiegman as England, crowned European champions for di first time last year on home soil - show dia superiority and know-how to see off Australia side wey dia entire kontri dey ginger.

Ella Toone give England di lead in di first half wit a superb first-time strike.

Di Lionesses control proceedings until di second half wen Australia throw evri tin at dem and star striker Sam Kerr - starting her first match of di tournament - strick a 25-yard stunner over goalkeeper Mary Earps head to make am 1-1.

But England, as dem dey so often do, find dia way back into di game wen Lauren Hemp pounce on a defensive error to restore dia lead, before Alessia Russo score di last goal.

Second Half

England vs Australia

Wia dis foto come from, Getty Images

FULL-TIME: Australia 1-3 England

90+3mins: Di fans of Australia dey chant " Na we be di Matildas"

81mins: SUBSTITUTION! Na now or never for Australia. Defender Clare Polkinghorne come off and forward Emily van Egmond replace am.

76mins: England dey so dangerous but Alessia Russo no loose guard dis time around as she pass am give Gerogia Stanway

73mins: SUBSTITUTION! Australia make switch as Hayley Raso come off for Cortnee Vine.

Australia 1-2 England

71mins: GOOOOAAAAAAAAL – Lauren Hem

65mins: Australia player join wit Sam Kerr dey come forward again but di tackle from Jess Carter no allow anoda sweet goal.

Australia get corner.

Australia 1-1 England

63mins: GOAL! SENSATIONAL EQUALISER by Sam Kerr

56mins: England dey very comfortable and Australia no dey create much chances.

52mins: England dey push very high as dem no dey allow Australia to settle.

50mins: Anoda chance for Australia. Mary Fowler fire cross but Caitlin Foord head am straight at Mary Earps.

46mins: England dey start well as dem dey confidently knock di ball around on di right.

Australia 0-1 England

Second half don start

First Half

Australia 0-1 England

45mins: HALF-TIME

45mins: Injury Time - Just one minute added time

Australia 0-1 England

42mins: Australia don dey shake and dey never change dia tactics but demstill dey push

Mary Fowler see Caitlin Foord running down di right but her ball go over di post

36mins: GOAL! Awesome goal from Ella Toone

Di ball roll pass Alessia Russo straight into di hand of Ella Toone.

34mins: For di last few minutes, Australia don step up dia game.

England dey drop-off.

28mins: England dey frustrated after Hayley Raso bin catch Rachel Daly for di sideline.

25mins: Sam Kerr win free-kick for Australia but e end for di halfway line.

Australia 0-0 England

18mins: Australia get gap for di back and England dey use dat opportunity.

Ella Toone fire wide enter Alessia Russo leg wey stretch Mary Earps.

Russo fire from a very tight angle but e touch di side net

13mins: England bin come again as Rachel Daly triy to find Lucy Bronze for di box, but Steph Catley head am go corner for England.

9mins: GREAT SAVE! England suppose dey 1-0 up!

Straight from di oda end Alex Greenwood put di ball over di defence wey land for Georgia Stanway.

Stanway get enough time as she strike towards di goalpost but Mackenize Arnold use boot bloc am.

5mins: Australia dey allow England to hold di ball. Di two teams still dey try get into di game as Lauren Hemp overhit one pass for Ella Toone.

3mins: Di host Australia never get hold of di possession as England dey play some very nice football wia dem wan enter from di right side.

Australia 0-0 England

2mins: England Millie Bright don launch di ball forward but di Australia defence handle am well.

1min: KICK-OFF

England vs Australia Line-Up

England vs Australia

Wia dis foto come from, BBC Sport/Getty Images

England: Mary Earps, Alex Greenwood, Millie Bright, Jessica Carter, Lucy Bronze, Keira Walsh, Georgia Stanway, Rachel Daly, Ella Toone, Lauren Hemp, Alessia Russo.

Australia: Mackenzie Arnold, Clare Polkinghorne, Steph Catley, Clare Hunt, Ellie Carpenter, Caitlin Foord, Hayley Raso, Katrina Gorry, Kyra Cooney-Cross, Mary Fowler, Sam Kerr.