Five things you need to know about WAEC CBT

Wia dis foto come from, RIVERS STATE MINISTRY OF EDUCATION
Di West African Examinations Council go use Computer-Based Test mode to conduct di Senior School Certificate Examination.
WAEC announce on Monday say dem dey drop di paper and pencil test model wey dem dey use .
Dis na eviritin you need know about WASSCE CBT for private candidates.
Wen WASSCE go start CBT test?
Computer based test for private candidates for West African Senior School Certificate Examination go start February 2024.
Na wetin di exam join body tok for inside statement wey dem release.
Normally di exam council dey conduct two exams evri year.
Di first one dey happun for May/June for school candidates wey dey SS3 class for a recognised school.
Followed by di October/November exam wey be di second one for private candidates.
End of Di one wey oda users dey read well well
But wit dis announcement now di private students timetable don change.
How WASSCE CBT go work?
Di exam join body say di objective test go dey fully computer based.
While di Essay and Test of Practical papers go be hybrid.
Wetin dis one mean?
E mean say dem no go use question papers again during di exam at all.
Di examination questions dem go put am up for screen and dem go provide booklets.
Candidates go den write di answers inside di booklets wey di examiners go share give dem.
Wia dem go do WAEC CBT exam?
WAEC say dem go conduct di exams for Urban centres/ cities for di kontri.
Di exam council say dem consider candidates wit special needs during di planning process and dem add say dem factor all dia needs.
Wen registration go start?
Registration for di exam go begin on Monday 18 December 2023.
To help student to dey used to di new exam platform, di exam council say dem don make arrangement for mock examination wey dem go conduct for February 2024 before di real exam go begin.
Student need to sharpen dia computer skills so dat dem go dey fully prepared for di new system. Di exam council advise students.
Di last point na say WAEC wey be di oldest examination body for West Africa sub-region say dis new move dey in line wit global best practices.
Di West African Examinations Council na ogbonge examination board wey dey established under di law for West Africa to determine di examinations requirement for di English-speaking kontris for West Africa.
Dia work na to conduct examinations and to award certificates wey dey equal wit international examination authorities.
Wit dis new move di exam council don follow di Joint admission matriculation board wey introduce CBT years ago to test students wey wan enta Nigeria tertiary institutions.












