Helpers turn-up for woman wey dey feed on ‘rejected rice’ sake of economic hardship

Shamsiyya Abubakar

Shamsiyya Abubakar don begin to lose renewed hope.

Dis na sake of say Nigeria economic kasala make am hard for her to fit feed her family.

E reach for di 32 year old to dey cook afafata, wey be di rice wey millers dey troway afta dem sort finish becos e dey too hard.

Ms Abubakar wey be mama of new pikin tell BBC Pidgin say di mata make her mind go some bad places.

She tok for interview, in Hausa, wey blow for Nigeria say, "Sometimes I go just reason say: 'e no beta make I die dan to dey live like dis?'"

But since tori go out on Tuesday, strangers don start to dey full her house dey wit food and money.

Wen BBC fit reach am di second time, she tok say di response don "change her life".

"I neva see dis kain plenty money for my life... I really dey grateful. I bin get money from plenty pipo while odas buy bags of beta rice and maize so now we get enof food to chop."

Her husband, Haruna Abubakar too don dey jolly di way dia tori take change.

E say, "di day of di BBC video, we bin no get anytin to chop, I bin struggle to find 500 naira so dem go fit buy cups of rice. Today I be happy man, as our lives don change and we don get enough to chop."

Woman in Afafata
Woman in Afafata

Sani Isah, wey be one of di pipo wey carry supply give di family say Ms Abubakar tori make am cry and move am to help wit di little wey im get.

E tok say, "I tink her tori na shame to our leaders, I bin actually cry afta I watch di video. How pesin go pray to die instead of to live sake of food? I pray say odas wey dey face wetin she go through go find di help dem need wey go change dia lives."

Nigeria dey face di worse economic crisis wey dem don see in a generation wey don cause hardship and anger.

On Tuesday, thousands waka for nationwide protest on top how goment dey treat di kasala.

Na di ogbonge rise of food dey vex pipo pass.

Rice wey be regular food for Nigeria, don double in price ova di last year.

No be only Ms Abubakar dey use broken, doti and tough afafata grains bEcos di low price wen compared to rice mean say struggling families for di north dey use am take survive. Plenti odas dey go hungry or dey ration di food wey dem get.

Ms Abubakar feel say bEcos of strangers, she now fit look to di future.

She tell BBC say so she go fit feed her family for future too, she dey plan to start business with some of di food wey dem dash am.