Hardship push some Nigerians to buy bad rice despite plenty stone and dirty inside

Wetin we call dis Video, To buy basic food items for Nigeria now don become gold sake of high cost of living
Hardship push some Nigerians to buy bad rice despite plenty stone and dirty inside

To buy basic food items for Nigeria now don become gold sake of high cost of living for di kontri.

Prices of common food items like rice, beans, garri, yam, pasta, flour, vegetable oil among odas don don go up.

Dis don make families adjust dia feeding habits or turn to alternatives - Many families for North now dey go for ‘Afafata’.

For many Northern Nigerians, dem dey turn to rice grains wey millers dey normally sell give farmers to feed dia fish.

Dem dey call dis kain rice “Afafata” for Hausa language wey mean “battling”, dis one na becos dem dey battle to cook and eat di rice as e dey very hard.

"A few years ago, pipo no care about dis kain rice, we dey usually throw am away along wit di rice hulls, but times don change," Isah Hamisu, one rice mill worker for di northern city of Kano, tell BBC.

Even though di grains no good, e don break, e dey dirty and hard, di cheap price dem dey sell afafata don make am more attractive to pipo as e dey help poorer families to fit afford to chop one of di common foods for di kontri.

As rice no dey dey affordable again, some families for southwest dey turn to beans - one food wey no be many pipo favourite and di beans too don become no go area now as di price don go up.

Video: Monday Idara