Why I dey bring back di old food wey our forefathers dey chop
Why I dey bring back di old food wey our forefathers dey chop
Amah Baptist Peter, wey pipo sabi am as Baptist Nature kitchen dey on a campaign to bring back di food wey pipo dey chop in di olden days.
And a major part of dat na to cook di food surrounded by nature and to make di food free from chemical preservatives and to make am as natural as possible.
Di obonge chef tori to BBC Pidgin how e start di journey.
How im develop di passion and how cooking save am from depression. Baptist also say im goal with im cooking na also to give back to nature and serve humanity.
E don start by taking di campaign to orphanages where e dey cook for di children dia.
Video by Monday Idara.



