Russian-Ukraine war: Negotiators of Russia, Ukrainia and US dey go Abu Dhabi

Read am in 5 mins

Negotiators of Russian, Ukrainian and US dey go Abu Dhabi wia di first tok-tok between dis three kontris go hold since Russia full-scale invasion of Ukraine for February 2022.

Dis tok-tok dey important well-well for Ukraine and na chance to see weda Moscow dey really serious about peace or dem just dey play games.

Ukrainian President Volodymyr Zelensky say dia meeting na "a step - hopefully towards ending di war", im add say di meeting go focus on di status of Ukraine eastern Donbas region

For di World Economic Forum for Davos on Thursday, im tok say im bin don reach agreement wit Trump on future US security guarantee for Ukraine in any deal happun.

Dis dey come afta Russia President Vladimir Putin and Donald Trump envoy bin hold wetin di Kremlin call "useful" but "very frank" tok for Moscow.

For di Air Force One last night, Trump say im believe say Putin and Zelensky "both of dem wan to make deal", im add say "we go find out"

As dem dey plan for dis meetimg, Overnight, both Ukraine and Russia don report drone attacks.

For messages wey dem post on Telegram, Penza Oblast govnor Oleg Melnichenko claim say drone attack bin cause fire for one oil depot for Penza, di area dey for south east of Moscow.

While for Ukraine, di general staff of di armed forces don also report air attack as drones hit 12 locations overnight.

Di recent Russian strikes ontop key infrastructure dey target many pipo for Ukraine so dat dem go face freezing temperatures without light to on heater.

For one update on Telegram Friday morning, as temperatures dey between -10C, di mayor of Kyiv say currently na 1,940 multi-story buildings dey without heating. Im say na sake of attacks wey happun early dis month.

Ukraine dey face serious acute energy crisis afta months of relentless Russian attacks ontop dia infrastructure.

Zelensky say Moscow dey deliberately exploit dis cold winter and e don leave tens of thousands of pipo across Ukraine without lifght, heating or running water.

Most of di conventional power plants for di kontri don dey hit or damaged by Russian air strikes, and Zaporizhzhia - Ukraine biggest power plant - na Russia dey control am since di war start.

The future of di site na one of di most critical points of any possible future peace deal between Ukraine and Russia.

Timeline of some of tok-tok wey don happun

Plenti tok-tok an dmeetings bin don happun before, some some of dem here:

Riyadh, March 2025

Ukraine and Russia bin agreed to naval ceasefire for di Black Sea for separate deals with di US afta three days of tok-tok for Saudi Arabia.

Istanbul, May 2025

Delegations from Ukraine and Russia bin agree to swap 1,000 prisoners of war each afta dem bin hold di first face-to-face tok-tok with each oda since Moscow full-scale invasion of Ukraine.

Anchorage, August 2025

Di first meeting since 2018 wey Donald Trump and Vladimir Putin shake hands for Alaska - though dem bin make small progress towards peace.

Putin tell tori pipo afta di meeting say dem bin reach unspecified "agreement" but stress say dem need to remove di "root causes" of di conflict before peace go come.

Geneva, November 2025

American and Ukrainian negotiators bin meet for Switzerland for tok-tok with one 28-point US-backed peace plan.

Afta some pipo bin criticise di original draft say e favour di Kremlin pass, dem bin update di peace framework.. Zelensky bin tok say e bin include "signals say di President [Donald] Trump team dey hear us".

Moscow, December 2025

Di Kremlin bin say na five hours of tok-tok between Putin and Trump top negotiator - Steve Witkoff - and e bin fail to produce any breakthrough, as Moscow bin no gree accept part of di new peace plan wey include over territory.

Berlin, December 2025

One meeting wey bin happun between European officials and Kyiv delegation bin lead to di US offering Nato-like security guarantee, while Zelensky bin signal for di first time say im fit "compromise" on ambitions to join Nato in exchange for strong guarantees.

Miami, December 2025

Shortly before Christmas, US and Ukrainian envoy bin focuse on aligning positions on one US-backed 20-point plan for Miami tok-tok, while US officials bin also meet Russian envoy Kirill Dmitriev.

Mar-a-Lago, December 2025

Zelensky and Trump bin meet for di president resort for Florida, where di Ukrainian leader say tok-tok about di revised peace plan bin dey "close to 95%" done.

Davos, January 2026

Zelensky bin declare say peace tok-tok don reach "di last mile" afta im bin meet Trump on di sidelines of di World Economic Forum, wia im bin tok say dem bin reach agreement on post-war security guarantee.

We go dey update dis tori