Ukraine and Russia exchange heavy strikes overnight as dem call for Trump-Zelensky meeting for US

Read am in 5 mins

Na at least seven pipo don die sake of di overnight Russian strikes on Ukraine capital, according to di Kyiv mayor Vitali Klitschko.

BBC don verify two locations wey show damage for di city based on fotos wey di Ukraine Prosecutor office bin release.

Di Ukrainian Air Force say di attack involve cruise and Kinzhal hypersonic air-launched ballistic missiles as well as Russian Shahed drones.

Footage verified by BBC show serious damage for one supermarket distribution centre for di Sviatoshynskyi district.

Di company - Novus - don confam say four delivery drivers dey killed for di strike and di site no dey currently operational.

"Dem build and open di centre during di full-scale invasion as a symbol of resilience, development and faith for di future... Despite di blow, shortage of goods no go dey for di stores," Novus tok for dia post for Facebook.

We also see damage to residential high-rise building located around 8km (5 miles) to di west of di Novus site wia several floors be like say e don damage.

Call for Trump-Zelensky meeting

Ukraine security chief say e dey hope to arrange for President Volodymyr Zelensky to visit di US "for di earliest suitable date" dis month, as diplomatic attempt to end di war dey kontinue.

Rustem Umerov, di head of Ukraine security council, tok on Tuesday say di US and Ukraine bin don reach "a common understanding on di key terms of di agreement discussed" bifor for previous tok for Geneva.

Di White House neva comment on di prospect of Trump-Zelensky tok.

Meanwhile, di US don confam say dia officials don set to meet Russian representatives for Abu Dhabi.

Fighting bin kontinue overnight, wit Russia and Ukraine exchanging air attacks.

Officials for Kyiv say pipo die for di Russian strikes on di city, while Russian officials say at least three also die for Ukrainian strike for di Rostov region.

Di meeting between Trump and Zelensky na to complete final steps and make a deal" wit US President.

A US official tell di BBC say Ukraine don "agree to a peace deal", say "some minor details still dey to sort out", without giving specific details.

Leaders for Kyiv and Europe don criticise di initial draft of a peace plan, wey dem tok say dey too favourable to Russia.

Counter-proposals - reportedly drafted by di UK, France and Germany - no include any recognition of Russian-held regions, raise Ukraine permitted army size, and leave di door open to Ukraine to join Nato.

Zelensky welcome di proposed changes to di controversial 28-point US peace plan.

"Now di list of necessary steps to end di war don become doable," Zelensky say. "Many correct elements don dey inside dis framework."

A Kremlin official reject di amendments as "completely unconstructive". Howeva, one US official on Tuesday tell di BBC say e mean say dia team go meet Russian representatives for Abu Dhabi to further discuss di plan.

Russian Foreign Minister Sergei Lavrov – wey no dey attend di meeting say di Kremlin neva receive di "interim" version of di revised plan, say Moscow view na say make e reflect "spirit and letter" of di Alaska tok between Trump and President Vladimir Putin for August.

Di latest on Russia-Ukraine war

Di latest round of tok come as Russia and Ukraine exchange overnight strikes.

Kyiv military administration chief, Tymur Tkachenko, say a fire bin break out for one high-rise residential apartment building for di Dniprovskyi district, forcing di residents to run comot.

Emergency services for di scene say dem rescue 18 pipo, including three children, and di search for victims dey ongoing afta dem put out di fire.

Residents of a high-rise apartment di city central Pechersk district also run comot afta dem set am on fire during di strikes according to Kyiv mayor Vitali Klitschko.

E add say di building suffer damage to di upper floors, but dem don put off di fire.

Ukraine air defence units respond to di attack as dem hear explosions across Kyiv and dem ask residents make dem take shelter for underground car parks and bunkers.

Ukraine Ministry of Energy also confam a "massive, combined enemy attack" on di country energy infrastructure facilities.

According to Zelensky, 22 missiles and more dan 460 drones dey launched for Ukraine overnight.

Nato bin try four planes ova Romania - di third time in four days dia planes don go intercept drones for Ukraine border region. Six Russian drones dey also detected for Moldova.

Meanwhile, di Russian defence ministry say e don stop 249 Ukrainian drones overnight, including ova di Black Sea and Kursk.

For Russia Rostov region, di death toll from a Ukrainian strike don rise to three, afta initial reports of one death, officials say.

According to Russia acting govnor of di Rostov region Yuri Sliusar, e say two die for hospital.

One of di deaths dey reported for di city of Taganrog, wia mayor Svetlana Kambulova promise "necessary response measures".

Anoda 10 pipo bin injure for di strikes.

For di southern Krasnodar region, Governor Veniamin Kondratyev describe Ukraine overnight bombardment as "one of di Kyiv regime most sustained and massive attacks".