You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Kurmin Wali residents accuse authorities of cover-up afta jaguda pipo kidnap more dan 150 pipo from three Churches
Di pipo wey dey live for Kurmin Wali, for Kajuru Local Govment Area of Kaduna State, for di northwest region of Nigeria, dey accuse govment authorities say dem dey try to suppress information afta Jaguda pipo attack di area and kidnap177 pip[o from three churches on Monday.
Some of di pipo tell BBC on Wednesday say govmnt officials no dey allow dem to tok to tori pipo and dem also dey block journalists from entering dia community.
One resident, wey beg make we no mention im name sake of security reasons, tok say di officials bin warned pipo to remain silent about di attack.
BBC tori pipo also find am difficult reaching Kurmin Wali as security pipo and govment officials bin order our team to turn back. Dem later grant dem access afta dem insist say dem must tok to di pipo.
Relatives of di pipo wey dem kidnap tok say di community still dey traumatised and neva still get adequate security days afta di attack.
Di Guvnor of Kaduna State, Uba Sani, also visit Kurmin Wali village on Wednesday and e promise to set up military base for di area.
E also announce say e go provide relief measures for affected residents, including medical support.
Di Kaduna State Police Command and local government officials bin first deny di tori as dem issue statement say di church attacks and abductions no hapun, but dem later do u-turn and confam say e hapun true-true.
Governor Sani explain say di initial denial na misrepresentation of di police position and e say na di public dey politicise di matter.
E say efforts don start to work wit security agencies to rescue di pipo wey dey for captivity.
Also, the tok-tok pesin for di Nigeria Police, Benjamin Hundeyin, also explain why e be like say dem no dey consistent wit dia statements about di attack.
For one television interview on Wednesday, Hundeyin tok say di Kaduna State Commissioner of Police bin explain say wen dem receive di information, dem immediately mobilise dia but dem no get any evidence say di attack hapun true-true.
"Di moment we get evidence, we also come out to say we don get evidence. So dia is no inconsistency," Hundeyin tok.
CAN blast police
Meanwhile, di Christian Association of Nigeria (CAN) don criticise di police for how dem bin manage di information surrounding di abductions.
Joseph Hayab wey be di CAN Chairman for Northern Nigeria tok for one TV interview say dis no be di first time wey attacks go hapun and police gho wan deny am.
"Di manner di police commissioner and oda security agencies come out to outrightly say dat dis tin bin no happen, to me na total disappointment, total failure, and e just increase di lack of trust wey exists betwin di pipo and dose wey suppose to dey secure dem," Hayab tok.
"Look at di time dem bin use to deny am. Dat time na wetin dem suppose use to dey pursue di bandits, but dem chose to allow di bandits to have gone far bifor dem now come out to acknowledge say di information we bin give dem na true and e remain true."
Di Kaduna State authorities neva release official figures for di numba of pipo wey di bandits dem kidnap, but CAN don release di names of di 177 pipo wey di bandits kidnap for dis attack across three churches.
Insecurity in Nigeria
No group don claim responsibility for di attack so far, but armed gangs, wey many pipo dey call bandits, don dey carry out abductions for many parts of Kaduna state in di past.
Dis incident dey come less dan two months afta bandits bin kidnap more dan one hundred school children plus dia teachers for one Catholic boarding school for Papiri, Niger State.
Few days bifor dat, anoda mass kidnapping bin hapun for Kebbi State wia 25 students of Govment Girls Secondary School, Maga, bin dey abducted from dia hostel afta jaguda pipo attack di school and kill dia security man.
Earlier for di same November of 2025, e get anoda attack for one Christ Apostolic Church for Kwara State, for di north-central region of Nigeria, wia gunmen bin also kill three pipo and pack about 30 worshippers enta bush.
All di pipo wey dem kidnap for dis three incidents don regain dia freedom, but govment say dem no pay ransom to di kidnappers. Rememba say di Kwara church attackers bin ask for ransom of 100 million naira for eac of di pipo wey dem kidnap.
Dis latest incident go also add fuel to di accuse wey Preident Donald Trump of di US dey make against Nigeria say di kontri govment no dey do enuf to stop di genocide of Christians wey dey hapun for di kontri.
Di Nigeria govment reject dis allegation and dem maintain say di insecurity for di kontri dey affect both di christian and muslim population.