Chile wan give money to pikin wey dia papa kill dia mama

Wia dis foto come from, Courtesy of Garrido family
For her friends and family for Chile capital, Santiago, 25 year old Silvana Garrido na beta pesin wey dy full of life and love her three year old daughter.
Na why di tori say she die of suicide bin make dem smell sometin fishy.
Francisca Millán Zapata from AML Women Defence wey represent Ms Garrido family for court say, "from day one, her family and padi dem believe na femicide wey her partner commit".
Ms Millán Zapata say police and prosecutors bin no really send dia pap, instead dem believe wetin di victim ex, Fernando Flores tok.
E take four years of ogbonge fighting by di family before dem see justice. But for April 2023, court find Fernando Flores guilty say im push her from her house for di 23rd floor to die. Dem give am life imprisonment.
Di crime na wetin dem call femicide wey Chilean law call di murder of woman by her partner or former partner.
Fernando Flores gbab di tougher sentence sake of di killing fall under femicide but also under di kontri new Reparation Law for Victims of Femicide, Ms Garrido daughter go qualify for financial support.
Di girl wey be seven now dey qualified to collect monthly state allowance of 160,000 Chilean pesos ($200; £160) until she turn 18 years old.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di law wey pass for April na one of di most ogbonge legal move for Latin America to support relatives for region wey get some fo di highest femicide rates for world.
Di United Nations say for Latin America and di Caribbean, 4,473 women don die for gender related killings for 2021 for di region and 12 women dey die for gender-related attacks every day for di region.

Wia dis foto come from, COURTESY OF THE GARRIDO FAMILY
Danitza Pérez Cáceres wey be di executive director of Abofem, Chilean network of female lawyer wey specialize for gender rights cases say dis reparation law dey set ogbonge precedent for Latin America as first in history but make dem dey watch how dem go actually do am in practice.
Chile Minister for Women and Gender Equity, Antonia Orellana say di law come to support pikin dem wey na dia papa kill dia mama, so now di child get no mama and violent papa for prison.
Minister Orellana say di aim no be just to give money but torchlight dis violence as structural wahala.

Wia dis foto come from, MINISTRY OF WOMEN AND GENDER EQUITY
She insist say di problem big pass how di justice system don dey look femicide wey dey only dey look "victim and aggressor".
According to Minister Orellana, di koko of di law na ro protect pikin well-being and break di cycle of violence wey dey make children of aggressors turn to violent adults.
She argue say "di tin wey go work pass long term na to prevent di intergenerational transmission of violence".
Plus di allowance for pikin wey dia mama die, di law go give employment protection to survivors of attempted or frustrated femicides.
And under di new law, di family members go be priority for access to social services like psychological counselling and support.
Mr Orellana dey hope say lawmakers go follow pass bill wey go fit prevent femicides and abuse.
Di Right For A Life Without Violence law wey Ministry of Women dey back wan strengthen di institutional support wey dem dey give women wey wan escape areas of violence.
She believe say di number of femicides fit dey reduced but she see gender based violence as global kasala, wey no be only Latin America dey go through am.
For now, di monthly allowance di pikin of femicide victim Silvana Garrido go now dey collect dey welcome by her family.

Wia dis foto come from, COURTESY OF THE GARRIDO FAMILY
Di girl dey take care of by her grandmama and aunty, Brenda Garrido, wet be di two women wey carry di justice for Silvana Garrido fight for dia head.
Brenda Garrido say, "na support. Even though with today inflation rate, e no plenti, e fit help".
"Din institutions fail my sister, di state fail am, we say no be suicide, dem no gree hear. So I tink na good tin for my family".
Silvana Garrido Instagram page don dey open to di public and na space to take remember and fight for femicide victims.
Before she die, Silvana Garrido bin dey post plenti selfies with her daughter as dem dey laugh with di app funny filters and heart emojis for all di pictures.
Brenda Garrido smile when she dey tink about her sister. "She bin dey so full of joy and na di best mama for world. Her daughter just resemble am, dem be like two peas in a pod".













