NLC, TUC suspend nationwide strike for 30 days

Organised labour unions for Nigeria don suspend dia nationwide indefinite strike wey supposed start on Tuesday.
Dem suspend di strike action for one month.
Dis one dey inside one memorandum of understanding wey di president of Nigeria Labour congress, Joe Ajaero sign.
Di General Secretary of NLC Emmanuel Ugboaja plus including president of di Trade Union Congress Festus Osifo and im Secretary General, Nuhu Toro also sign di MoU.
"Di NLC and TUC accept to suspend for 30 days di planned indefinite Nationwide strike wey dey scheduled to begin, Tuesday, di 3rd of October, 2023." Di statement tok.
Di statement also go on to state some of di understanding federal goment and di NLC and TUC bin reach for di tok-to as a result of di protest sake of di removal, of fuel subsidy.
“Di Federal Government grant a wage award of N35,000 (thirty-five thousand Naira) only to all Federal Government workers beginning from di month of September pending wen dem go sign a new national minimum wage into law.
A minimum wage committee go dey inaugurated within one month from di date of dis agreement." E tok.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, BBC News
Pipo bin dey anticipate di next move of di Nigeria Labour Congress (NLC) and di Trade Union Congress (TUC) afta both unions meet wit di federal goment of Nigeria on 1 October to discuss mata wey dey ground as dem bin threaten industrial action.
Dis na one week afta dem do joint press for Abuja, to declare a nationwide strike scheduled for 3, October.
Di unions bin ask dia state chapters to mobilize for protests across di kontri.
But afta hours of meetings between di union heads and goment di unions don pull out of di strike.
Part of di unions demand na for di Nigerian goment to reverse some economic policies wey dem describe as anti-pipo policies wey don make life hard for pipo since di removal of fuel subsidy.
On 1 October, Nigerian goment for one statement by di minister of information and national orientation say dem don announce N25,000 provisional wage increment for all treasury-paid federal goment workers for six months, dem tok afta dem meet with di labour union leaders.
Goment say dem dey committed to provide Compressed Natural Gas (CNG) buses on time so e go fit ease public transportation difficulties wey di fuel subsidy removal cause.
Dem also say dem dey committed to di provision of funds for micro and small-scale enterprises, and add say dem go waive VAT on diesel for di next six months.
"Di federal goment go commence payment of N75,000 to 15 million households at N25,000 per month, for a three-month period from October-December 2023," di statement tok.
Di Nigerian goment say dia resolution wit di unions be say dem fit only resolve di issues wey dey ground wen workers dey for work and not wen dem dey on strike.
Di team wey represent di federal goment for di meeting say di unions want higher wage and dem promise to present dia request to President Tinubu for further consideration.
Di Nigerian goment also tok say dem don constitute sub-committee to work out di details of implementation of all items for consideration regarding di goment interventions wey go lessen di effect of fuel subsidy removal.
Before dis latest development, di two-day warning strike wey di unions bin plan across di kontri earlier on happun but e no happun as planned.














