Sudan conflict fit become worse dan dat of Libya - Former PM

Abdalla Hamdok

Wia dis foto come from, EPA

Sudan former Prime Minister Abdalla Hamdok don warn say di conflict fit become worse dan dat of Syria and Libya.

Di fighting between di regular army and di paramilitary Rapid Support Forces (RSF) go be a "nightmare for di world" if e continue, e tok.

Dis dey come as di fighting don tie wrapper for Sudan capital, Khartoum, as e scata di latest ceasefire wey dey aimed at allowing pipo to run to safety.

Di latest truce suppose end late on Sunday. Millions of pipo dey trapped for di capital, wia food dey run out.

Residents say as at early on Sunday, dem hear di sound of warplanes and heavy anti-aircraft fire for di capital Khartoum.

Di army say dem dey attack from all directions, wit heavy artillery to flush out im paramilitary rivals

Di fighting wey start on 15 April don leave hundreds of pipo dead, while thousands of pipo don run comot di kontri.

Thursday night extension of one ceasefire between di rival factions come afta ogbonge diplomatic efforts by neighbouring kontries, as well as US, UK and UN. But di 72-hour extension no hold water.

Meanwhile, for Port Sudan tins dey anyhow as pipo dey desperate to board ships, some wey dey head to Saudi Arabia and Yemen.

How tins bin dey go

Pipo dey run from di conflict

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Pipo dey run from di conflict

Despite international pressure for Sudan to maintain im latest ceasefire, di agreement get k-leg as tori of more missile strikes dey come in from parts of Sudan.

Around 2,000 pipo bin don land Saudi Arabia sea town of Jeddah afta dem evacuate dem from all di katakata and confusion wey dem face for Port Sudan.

Earlier, one Chinese military ship wey bin carry nearly 500 Chinese and Pakistan citizens also bin do di 12 hour crossing.

Meanwhile, di UK goment say dem don end dia evacuation operation. Di Foreign Office say di last flight comot Khartoum around 22:00 local time (20:00 GMT) on Saturday, and in total na nearly 1,900 pipo dem fly out.

US goment meanwhile say one US-organised convoy don reach Port Sudan to evacuate more US citizens by ship to Jeddah for Saudi Arabia. E say hundreds of Americans don already comot Sudan, in addition to di diplomats dem evacuate by air one week ago.

Foto afta violence for Dafur

Wia dis foto come from, Getty Images

So far, pipo from more dan 70 kontris don reach Jeddah from Port Sudan east of Sudan.

For di north of Sudan, Nigeria goment evacuate 637 Nigerians to Aswan border wey divide Sudan and Egypt.

Di Nigerians never cross di border as dem dey undergo necessary documentation and clearance before dem go fit enta Egypt territory for dia final evacuation to Nigeria.

Di goment bin say dem go begin movement for di second batch on Saturday.

Despite say many pipo dey run comot from Sudan, millions of pipo still dey stranded inside di capital city Khartoum, wia dem dey face shortage of food, water and fuel.

Map of Sudan and Saudi Arabia wey show Port of Sudan and Jeddah coastal city

RSF under fresh attacks

Smoke ova Khartoum on Friday - afta official extension of ceasefire

Wia dis foto come from, Getty Images

Di Rapid Support Force, di paramilitary group wey dey oppose di regular Sudan military, don accuse im enemy of carrying out several airstrikes on dia base and on parts of di capital, despite ceasefire.

Di group claim say na dem dey control di majority of Khartoum, but BBC neva fit confam dis.

Reports of serious violence dey also come from El Geneina, one city for Dafur west of Sudan, wia tori be say militants dey steal and burn markets.

Di fight bin start two weeks ago sake of bitter power struggle between two Sudan military factions.

One of di generals wey dey cause di fight, Hemedti, tell BBC on Friday say im no go negotiate until di fighting end becos dem dey “relentlessly” bomb im troops.