Fashola petition social media users over allegation say e write judgement for presidential election court

Wia dis foto come from, Hakeem Bello/Facebook
Former minister of works and housing don write petition to Nigeria Inspector general of police following on top mata wey concern ‘cyber stalking’.
Di petition na against three twitter users wey accuse am of allegedly writing di judgement of di presidential election court wey dey hear di matter wey concern di 2023 presidential election.
Di appeal panel led by Justice Haruna Tsamani don reserve judgement on di matter.
Since den, tori begin fly upandan say some pipo dey write di copy of di judgement wey di appeal panel go read.
Di Twitter users list oga Fashola as pesin wey dey draft di judgement.
Apart from being former minister, oga Fashola na former govnor of Lagos state and Senior advocate of Nigeria.
Im na ally of Nigeria president Bola Tinubu – but im no follow for di lawyers wey dey involved for di case.
Oga Fashola for im initial response completely deny di tori as fake. E say im no dey too dey Abuja like before.
End of Di one wey oda users dey read well well
E also join microblogging site, X plus di National Communications Commission (NCC) for di petition.
How di tori begin trend
Fahola begin trend on social media afta one Twitter user bin post one informate wey allege say di former Lagos govnor wey bin also serve as minister of Works and Housing and some APC lawyers dey allegedly write di judgement.
Di user further claim say Bola Tinubu and APC dey plan to handover di allegedly written judgement give di Presidential Election Petition Tribunal make dem adopt. Fashol maintain say na ogbonge lie.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Di tweet allege say “Di former Lagos govnor dey quiet since afta di election but e dey close mark di judges wey dey handle di presidential election petitions.
“Di election tribunal don adopt all dia final addresses but dem neva announce date for di judgement. Fashola, according to informants dey work day and night to conclude im proposed judgment and handover to di Pept judges." Di tweet tok.
E add say apart from di monetary compensation dem don [promise di judges, dem go also promote dem go di Supreme Court if dem accept Fashola version.
Last week di presidential election petition court wey sit for Abuja bin reserve judgement for di petitions wey Peoples Democratic Party, PDP presidential candidate Atiku Abubakar and Labour Party presidential candidate, Peter Obi bring against President Bola Tinubu.
Di five-man panel of judges reserve judgement afta dem adopt di written addresses on preliminary objections and final written addresses of di petitioners and respondents on Tuesday 1 August 2023.
Chairman of di presidential election petition court, Justice Haruna Tsamani say:
"Judgement dey reserved to a date wey we go communicate to una."
Atiku Abubakar and Peter Obi dey challenge di declaration of Bola Tinubu by di Independent National Electoral Commission, Inec as winner of di 25 February presidential election as dem allege say mago-mago for di election.













