World oldest man share 'special secret' to long life

Wia dis foto come from, PA Media
- Author, Gemma Sherlock & PA Media
- Role, BBC News, Merseyside
- Read am in 4 mins
Di oldest living man for di world say im no get any "special secrets" to tell pipo about im long life as e celebrate im 112 birthday.
John Tinniswood, wey dem born for Liverpool on 26 August 1912, tell Guinness World Records say im "no get any idea" why im don live for so long.
Oga Tinniswood wey be Liverpool fan for life, dey live for one care home for Southport. E become di world oldest living man for April, wen Juan Vicente Pérez Mora wey be 114-year-old die.
E say im bin dey "quite active wen im dey young" and im "waka well well", but believe say im "no dey different" from anyone else, e add say: "You either live long or you live short and nothing much you fit do about am."
Oga Tinniswood, wey dem born di year wey di Titanic sink, say im go take turning 112 "like normal tin".
"I no get any idea why I don live dat," e tok. “I no fit think of any special secrets wey I get.
"I bin dey quite active wen I dey young, I waka well-well... weda dat one get something to do wit am, I no know.
"But to me, I no dey different. No different at all."
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Family photo
Dem born Oga Tinniswood 20 years afta dem establish im favourite football club Liverpool.
E don live through all but two of di Reds' 66 top flight trophies, e miss di first two league titles for 1901 and 1906.
E be two-year-old wen di World War One start and e bin just celebrate im 27th birthday wen World War Two begin.
E bin serve for administrative role for di Army Pay Corps, wia e dey local stranded sojas and dey arrange food supplies for dem.
Now e be di world oldest surviving male WWII veteran.
E meet im wife, Blodwen, for one dance for Liverpool, and dem marry for 1942.
Dem born dia daughter Susan for 1943. Di couple bin enjoy 44 years togeda bifor Mrs Tinniswood die for 1986.
Afta World War Two, e work as accountant for Shell and BP bifor e retire for 1972.

Wia dis foto come from, PA Media
E say apart from say im dey chop fish and chips evri Friday, im no follow any particular regime.
"I dey chop wetin dem give me and na so everybody dey do," e tok. "I no get any special diet."
Since e turn 100 for 2012, every year, e dey get birthday card from di monarch - first from di late Queen Elizabeth II, wey be im junior by almost 14 years, and then from King Charles III.
Wen dem ask am weda di world don change well-well from wen e dey small, e say di world don change "no beta in my opinion, or hardly any pass, pass as e be then".
"Probably for some places e beta, but for oda places e dey worse," e add.
Di oldest man ever na Jiroemon Kimura from Japan, e live to di age of 116 years 54 days and e die for 2013.
Di world oldest living woman, and oldest living pesin na Tomiko Itooka, she be 116-year-old from Japan.














