Who be di Mexican influencer wey dem kill live on TikTok?

Wia dis foto come from, Reuters
- Author, Ottilie Mitchell
- Role, BBC News
- Read am in 5 mins
Wen dem bin shoot 23-year-old Mexican influencer dead wen she bin dey live stream on TikTok, rumours begin spread.
Na cartel hit? Or anoda tragic example of violence against women?
On Tuesday, dem bin shoot Valeria Marquez dead for Blossom The Beauty Lounge, her own beauty salon for Zapopan, one town for di central-eastern state of Jalisco.
Di state prosecutor office say dem dey investigate di crime as a femicide, wey mean say dem believe say di crime dey motivated by di fact say di victim na woman.
Di president of Mexico, Claudia Sheinbaum, say investigation dey go on: "We dey work to catch di pipo wey dey responsible and find out why dem do am."
But di fact say di crime happun for Jalisco, di state wia di Cartel Jalisco Nueva Generación (CJNG) wey pipo dey fear well-well start from, don lead to speculation by some pipo say di cartel fit get hand inside somehow.

Wia dis foto come from, Reuters
Rising star
Ms Marquez na former Mexican model wey bin start to make name for herself for 2021 afta she bin win di Miss Rostro (Miss Face) beauty pageant, according to Mexican media reports.
E no tey, she start to create content on social media. She go share makeup tips and personal care routines, tok about fashion and show off her travels.
You go see fotos of her on private jets and yachts for her Instagram account, wey get more dan 223,000 followers at di time of her death.
Ms Marquez also get anoda 100,000 followers on TikTok.
Although e no dey clear exactly wetin happun, during her final livestream, Ms Marquez bin tok say she bin dey wait for a courier wey she already sabi to deliver a gift.
She bin add say she bin dey a bit worried, becos her friend no fit see di courier pesin face wen im bin arrive.
"Why im no just drop am (di gift) go? Dem bin plan to pick me up (kidnap me) or wetin?" she bin dey wonder aloud to her followers.
As she hold one pink toy animal, Ms Marquez bin look away from di camera and immediately grab her chest and belle before she collapse into her chair.
Anoda woman den collect di phone and end di livestream.
Police bin land for di scene around 18:30 local time (12:30 GMT) and confam say Ms Marquez don die, according to di state prosecutor.
Authorities tok say at least two men on motorcycles bin come di salon and one of dem bin ask di victim if she be Valeria.
Wen she answer "yes," im bring out gun come shot her at least two times before im run.
Investigators say dem dey check di CCTV footage and dem dey track Ms Marquez social media accounts for clues to know who di attackers fit be.

Wia dis foto come from, Getty Images
Motive still unknown
But di location wey di salon dey for di wealthy Zapopan area of Guadalajara dey raise questions about di motive for di crime.
While di presence of private security and how di streets clean dey give di impression say di Zapopan area dey safe, but in reality, na one of di most violent municipalities for Jalisco. In fact, shootings dey regularly happun for luxurious shopping centres for di area.
More dan half of di real estate and commercial development for di area dey connected to di laundering of drug trafficking money, according to di US Department of Justice.
Jalisco rank di sixth among Mexico 32 states, including Mexico City, in terms of homicides, dem don register 906 murders since di beginning of President Claudia Sheinbaum term in October 2024, according to data consulting firm TResearch.
Na also one of di Mexican states wey dey most affected by di cartels. Na for hia, 50 kilometres from Zapopan, wey dem bin see one cartel training centre for March, and na for hia wey 15,000 pipo bin disappear since 2018.
Di same day wey dem kill Márquez, dem bin also murder one former congressman named Luis Armando Córdoba Díaz just two kilometres away, according to di newspaper Reforma.
According to di state of Jalisco, dem no dey report or investigate as many as 90% of crimes.
Dem don also accuse di state attorney office say dem too get links to cartels, but dem deny am.
Di prosecutor office tok say, so far, dem no get any reason to suspect say Ms Marquez murder dey ordered or carried out by any of di organised criminal groups wey dey operate for di area.
Instead, di office bin suggest say di murderer fit dey motivated to kill her sake of her gender.
Mexican media outlets bin don publish messages wia Ms Marquez bin blame her ex-partner if anytin happun to her.
Mayor of Zapopan Juan José Frangie say im office no get any record of Ms Marquez wen she dey request help from di authorities due to threats against her, dem add say " femicide na di worst tin", according to news agency AFP.
"In response to claims wey dey point to alleged perpetrators of di femicide for Zapopan, we clarify say no direct accusations dey against any individual for di investigation file," di Jalisco prosecutor office tok for statement.
"We dey analyse all statements and clues, including videos and social media posts. Di investigation is being conducted under di femicide protocol, wit a gender perspective, without revictimisation and in accordance wit di principles of legality, impartiality and respect for human rights," e add.
Gender-based violence na serious problem for Mexico, a kontri wey rank fourth for Latin America and di Caribbean for rates of femicide, behind Paraguay, Uruguay, and Bolivia.
According to di latest data from di United Nations Economic Commission for Latin America and di Caribbean (ECLAC), dem bin get a record of 1.3 deaths per evri 100,000 women for Mexico in 2023, na wetin Reuters bin report.
Less dan 48 hours before Ms Marquez murder, dem bin kill Yesenia Lara Gutiérrez, one candidate wey bin dey contest for mayor for Morena (di ruling party) for di city of Texistepec, Veracruz, wen she bin dey participate for one political motorcade. Like di influencer case, dem bin record di murder of di politician for recorded cameras becos dem bin dey live-stream di event for Facebook.










