Key points from President Joe Biden first speech afta e wash hand comot White House race
- Author, Anthony Zurcher
- Role, North America correspondent
- Read am in 4 mins
Na Joe Biden first chance to define how history go judge am.
Inside one rare televised address from di Oval Office on Wednesday night, im first public comments since e end im re-election bid on Sunday suddenly, e speak of im accomplishments. E speak of im humble roots. E sing di praises of di American pipo. E say di future of American democracy dey dia hands.
Wetin e no do, despite say e bin tok say e go always come out level - plain - with Americans, na to provide a direct explanation for di biggest question of di day.
E no tok why e don become di first incumbent president to abandon a re-election bid, just few months before voting suppose begin.
And dat na wetin di history books go dey di most interested in.
E hint am. E talk go here and dia around di mata. But e no tackle am head on. E bin dey left for di American pipo to read between di lines.
“In recent weeks,” Mr Biden say, “e don become clear to me say I need to unite my party.”
E come talk again about wetin don become chorus among Democrats - say time don reach to “pass di torch” to a new generation.
End of Di one wey oda users dey read well well
While e say im accomplishments, wey e list in detail, merit a second term in office, e add say “nothing fit come in di way of saving our democracy – and e include personal ambition.”
Wetin e no talk na di cold, hard reality say e resign because e bin dey become clear everyday say e go lose to Donald Trump for November. And dat na outcome wey those for im party generally see as problem.
E bin dey behind for polls, dey embarrassed by a bad debate performance and with a growing chorus for di Democratic Party wey dey call for am to step aside, clear path bin no dey for Biden victory.
While di president no tok so, im Republican predecessor - and now former rival for di White House - no hold back.
For one rally for Charlotte, North Carolina, few hours before di address, Donald Trump say Mr Biden drop out because e bin dey lose badly.
Den e go on to attack Kamala Harris, di party new presumptive nominee, claim say she be “radical left lunatic” and di “ultra-liberal driving force behind every single Biden catastrophe”.
Republican groups don dey flood di airwaves for key battleground states, in attempt to define Ms Harris in dia terms, not her own. According to research by di Associated Press, Trump side fit to outspend dia Democratic counterparts 25-to-1 over di course of di next month.
One advertisement bin dey say Ms Harris bin get hand in covering up di president “obvious mental decline”.
Mr Biden speech provide for a nationally televised, primetime opportunity to provide reply to di attacks against im vice-president and to address concerns about im ability to continue to fulfil im presidential duties.
Na opportunity wey for di most part e no take.
Towards di end of im speech, di president bin talk for im running mate. E say Ms Harris dey “experienced, tough, capable” and na “incredible partner for me and a leader for our country".
Dem be strong words, but di words no plenty. E bin spend more time discussing Benjamin Franklin dan e talk about im vice-president – di person e endorse on Sunday, and di one wey go be di most important torch-carrier for im legacy in di coming months.
With little cover from di president, Ms Harris and her team go get to decide whether, and how, to respond to di attack from Republicans in di coming days.
Mr Biden fit get anoda chance to hype im former running mate for di Democratic convention for Chicago next month, but dis na delicate time for di new presumptive nominee, as her campaign just dey wan start and Americans still dey get to know her.
Di president fit don dey uncomfortable to dey too political for wetin fit be im final Oval Office address. But if e dey concerned about im legacy, Harris success or failure, more dan anything else wey e do from here on, matter.
E go determine whether history go judge am as man wey make a noble sacrifice, or person wey put im party at risk by selfishly holding on to power for too long.

















