Who be Nentawe Yilwatda, ruling APC new National chairman

Prof Nentawe Yilwatda on blue cap

Wia dis foto come from, Prof Nentawe Yilwatda/Facebook

Read am in 4 mins

Di ruling All Progressives Congress (APC) don announce Professor Nentawe Goshwe Yilwatda as dia new National Chairman.

Di Proferssor go replace Abdullahi Ganduje wey resign from di position for June.

Dem choose di new chairman for dia 14th meeting of di National Executive Committee (NEC) wey dem hold for Abuja on Thursday.

Appointment of Yilwatda dey come afta Ganduje resign for June 27, 2025, and Ali Bukar Dalori, di Deputy National Chairman of di party bin act till in dat capacity

Yilwatda na 56-year-old man from Plateau State and di current Nigeria Minister of Humanitarian Affairs, Disaster Management, and Social Development.

Di party leaders bin support Yilwatda for di position including President Bola Ahmed Tinubu, afta dem nominate am.

Profile of Nentawe Yilwatda

Dem born Prof Yilwatda on August 8, 1968, for Dungung, Kanke Local Govment Area of Plateau State.

E get degree for Electrical/Electronic Engineering from di Federal University of Agriculture, Makurdi for 1992, a Master degree from Abubakar Tafawa Balewa University, Bauchi, and PhD for Digital Systems Engineering from di University of Nigeria, Nsukka.

E be registered engineer wit di Council for di Regulation of Engineering for Nigeria (COREN). Also member of di Nigerian Society of Engineers, di Institute of Electrical and Electronics Engineers, and di Solar Society of Nigeria.

Yilwatda journey include both im experience for public and private sectors.

E bin serve as di Resident Electoral Commissioner for Benue State under di Independent National Electoral Commission (INEC) from 2017 to 2021.

For 2022, Yilwatda resign from INEC to contest for di APC govnorship primary for Plateau State,and e become di party candidate.

Meanwhile, e lose di 2023 election to Caleb Mutfwang of di Peoples Democratic Party (PDP).

For October 2024, President Tinubu appoint am as di Minister of Humanitarian Affairs, Disaster Management, and Social Development.

E go kontinu to dey hold im Minister role join di APC chairmanship position.

Professor Nentawe Yilwatda take oath of office

Wia dis foto come from, APC

Since 2014 wen dem form Nigeria current ruling party - APC all those wey don be National Chairman emerge through a consensus arrangement.

Since dat time, di party don dey lead Nigeria from late President Muhammadu Buhari wey do two term, and now Bola Tinubu wey dey elected for 2023.

Past APC Chairman

Abdullahi Ganduje

Di immediate-past Govnor of Kano state, Abdullahi Ganduje emerge as di National Chairman of Nigeria ruling party, di All Progressives Congress (APC), for 2023.

Di National Executive Committee of di party elect Ganduje for di 12th NEC meeting wey hold on Thursday, 3 August 2023 for Abuja, di kontri capital.

Senator Abdullahi Adamu bin emerge as di National Chairman of di All Progressives Congress (APC) for March 26, 2022 during di party national convention for Abuja.

For June 2020, afta di APC dissolve dia national working committee, dem set up one new interim committee and ask Mai Mala Buni to serve as di chairman.

Adams Oshiomhole

On 23 June 2018, Adams Oshiomhole bin emerge as di national chairman of di All Progressives Congress (APC) afta delegates vote for am for di party National convention.

On 16 June 2020, di Abuja Court of Appeal bin suspend am as di APC national chairman.

John Odigie Oyegun

John Odigie Oyegun na di first substantive national chairman of All Progressives Congress (APC) for Nigeria.

E serve as di leader of di party from 2014 – 2018. Oyegun bin lead di den opposition APC and Muhammad Buhari to victory for 2015

Bisi Akande

Chief Abdukareem Adebisi Bamdele Akande na one former govnor of Osun State, Nigeria from 1999–2003, e dey elected under di platform of di Alliance for Democracy (AD) party.

E serve as di first interim Chairman of di All Progressives Congress afta di merger.