APC National Convention 2022: Buhari meet APC leaders, consensus candidates dey table

APC National Convention: Buhari meet APC leaders, consensus candidates dey table

Wia dis foto come from, PresIDENCY

All Progressives Congress [APC] 2022 National Convention na big focus for many Nigerians now.

APC National Convention to chose new party leaders go hold on Saturday for Abuja.

Nigeria ruling party highest political mass gathering dey happun one year and nine months afta dissolving dia National Working Committee [NWC] in June 2020.

Electing new NWC members with substantive national chairman to replace Adams Oshiomhole go be di highpoint of di APC national convention.

Last minute meetings-upon-meetings na im dey take place for presidential palace Aso Rock sake of APC.

President Muhammadu Buhari na im dey host dis tok-tok to pave way for di 26 March, 2022 political gathering.

Buhari on Thursday evening meet APC members of di national assembly, according to presidential sources.

Thousands of politicians don dey already gada for Nigerian capital ahead of di big political meeting of di kontri governing party.

APC National Convention: Buhari meet APC leaders, consensus candidates dey table

Wia dis foto come from, Presidency

After dat meeting, tori be say dem don resolve to work towards choosing consensus candidates on Saturday.

Politicians wey di political party elect for dis long awaited meeting na im go lead di APC to contest di Nigeria 2023 general election.

Since 2014 wen dem form Nigeria current ruling party - APC all those wey don be National Chairman emerge through a consensus arrangement.

And as things be on Friday - a day before di party national convention - di All Progressives Congress fit adopt consensus candidates.

APC National Convention and Nigerian politics

Nigeria 2023 general election na big test for APC weda dem go remain di governing party of di west African nation afta Buhari full two tenures end.

Nigeria election office - Independent National Electoral Commission [INEC] don announce new dates for di 2023 general elections.

Presidential and National Assembly elections go happun for February 25, 2023.

While govnorship and State Houses of Assembly votes go hold on March 11, 2023.

For late February, President Muhammadu Buhari sign di Electoral Act Amendment Bill 2021 into law.

Dis new law go affect di way political parties go prepare for di 2023 general elections.

President Buhari, as leader of APC, begin hold series of meetings wit politicians of di party to settle all interests.

APC National Convention: Buhari meet APC leaders, consensus candidates dey table

Wia dis foto come from, Presidency

"Wen we bin come together to form di All Progressives Congress, nearly 8 years ago our goal dat time na National Salvation.

"Our resolve dat time bin dey unshakable, our motivation bin dey patriotic and noble".

President Muhammadu Buhari tok for meeting with members of Progressive Governors' Forum - wey be all serving state govnors wey be members of di party - on 23 March.

Buhari also host di founding fathers of di party to a dinner on Thursday night 24 March.

APC National Convention drama

All Progressives Congress 2022 national convention build-up don witness plenti drama for dia party headquarters for Abuja.

On Monday 7 March, 2022 police officers bin block all di entry point into di party office.

From di whole issue, Niger State Govnor Abubakar Bello assume office as di acting chairman of di Caretaker Extraordinary Convention Planning Committee of di party.

Di following day e approve di recommendation by di committee on zoning.

Dis na di position wey di govnor of Yobe State, Mai Bala Buni bin dey hold before e travel abroad.

Party leaders like govnors and lawmakers dem rush into di party headquarters to hold toks wit di Govnor Sani Bello, afta dat announcement.

APC National Convention: Buhari meet APC leaders, consensus candidates dey table

Wia dis foto come from, Presidency

A week later, President Muhammadu Buhari meet Chairman of di APC Caretaker/Extraordinary Convention Planning Committee [CECPC], Govnor Mai Mala Buni for London.

President Buhari, during di 15 March meeting, ask Buni to take charge of di APC convention and ensure say evri-evri go smoothly.

Di Nigerian leader also write a letter to Chairman of APC Governors' Forum, Atiku Bagugu, wia e order am to ensure say oga Buni take charge immediately.

A week afta di London meeting, court clear di way for Nigeria ruling party to hold dia big election alias National Convention on 26 March, 2022.

Between November 2021 and March 2022 APC don shift dia convention many times sake of internal party gbas-gbos.

Di party on Thursday block political appointees from voting as delegates at the for di convention.

"Di CECPC don declare say all political appointees, wey dey elected as delegates to di National Convention slated for March 26 no go vote.

"Na sake of di controversy surrounding Section 84 (12) of di Electoral Act, 2022." APC tok for statement.

"However, political appointees fit still attend as observers." di party statement add.

APC National Convention 2022: Buhari meet APC leaders, consensus candidates dey table

Wia dis foto come from, Twitter

Latest tori be say Senate President, Ahmad Lawan, don tok say "unity list" go ready and dem go make am public by Friday.

Of all di main aspirants for APC National Chairman post, tori be say former govnor of Nasarawa State, Senator Abdullahi Adamu fit become di consensus candidate.

APC national convention go hold for Eagles Square, Abuja and thousands of delegates from di 36 states and Federal Capital Territory dey expected to attend.

Di outcome of dis important APC National Convention go affect who fit grab di presidential ticket of di goment party to contest Nigeria 2023 general elections.