Who be di APC acting national chairman Ali Bukar Dalori wey replace Ganduje

Wia dis foto come from, TVC
Grassroot politician Ali Bukar Dalori don resume office as di Acting National Chairman of Nigeria ruling party, di the All Progressives Congress (APC), afta di unexpected resignation of Abdullahi Umar Ganduje.
APC National Secretary, Ajibola Bashiru, formally present Oga Ganduje resignation letter to di National Working Committee (NWC) during dia meeting earlier.
Tori around di resignation of Ganduje wey be di former govnor of Kano State no clear as im or di APC neva release any official detail about di mata.
Oga Dalori resumption as APC acting national chairman don draw attention as many Nigerians don begin ask about who im be.
Who be Ali Bukar Dalori?

Wia dis foto come from, TVC
Ali Bukar Dalori na grassroots politician from Borno State for, northeast Nigeria.
E come from Konduga local goment area of Borno State.
Dalori na former Chairman of di APC for Borno State.
During im time as di chairmo, e bin dey reported say Oga Dalori bin strengthen di party structure for local level.
End of Di one wey oda users dey read well well
For 2022, Dalori bin also hold office as di Deputy National Chairman (North), position wey make am popular for di national level of di All Progressives Congress.
Bifor e become party chairman for state and national level, Dalori bin start im political journey as councillor.
E later become chairman of Konduga local goment area, wia e dey popular well-well. Im commitment to governance, especially during di time of insecurity for di northeast region earn am ogbonge respect.
Dem name Dalori, wey be di Deputy National Chairman, as Acting National Chairman in line with Article 14 of di All Progressives Congress (APC) constitution.
Di APC National Working Committee (NWC) for dia process, bin follow dia internal rules and appoint Dalori to avoid leadership vacancy within di party especially for dis kain time for di political space.
As di most senior northern official for di party leadership, Dalori na di next in line by APC hierarchy.
Di party make di decision pending di time di National Executive Committee go fill di position permanently.
As e resume office, Oga Dalori bin acknowledge former chairman, Abdullahi Ganduje contributions and say thank you to am for im service.
Tok-tok wey dey go round within di party na say Dalori appointment na to douse tension from di northcentral party members, sake of dia fear say dem dey side-lined wen Oga Ganduje wey come from di northwest become chairman against earlier zoning expectations.














