APC NEC meeting: Gov. Buni na im be new APC national chairman as NEC meeting clear Ize Iyamu Edo primary election - Meet di new leadership of Nigeria ruling party

Governor of Yobe State, Mai Mala Buni don become di national chairman caretaker committee of Nigeria ruling All Progressives Congress (APC).
Dis dey come shortly afta dem dissolve di party National Working Committee (NWC) alias party executives during di meeting of di party National Executive Committee (NEC) wey happun on Thursday, 25 June.
Di decision follow recommendation of President Muhammadu Buhari wey also attend di meeting. For di meeting, dem also clear Pastor Ize Iyamu as di party candidate for di Edo state governorship election.
Dis dissolution of di party executives mean say di APC NWC no dey exist again until further notice. For di meantime a new caretaker committee na im go lead di goment party, di APC NEC meeting decide.

Wia dis foto come from, Bashir Ahmad/Twitter
Meet di APC Caretaker Committee and Extra-Ordinary Convention Planning Committee
1. Govnor Mai Mala Bun of Yobe State - Chairman
Dem bin elect am as Governor of Yobe State, north east of di kontri, for 2019. Im also be di caretaker chairmo of APC wey dem just appoint.
2. Isiaka Oyetola - South West
Adegboyega Isiaka Oyetola na di current Govnor of Osun state wey dem elect for September, 2018 afta im beat Senator Adeleke of di PDP for di polls.
End of Di one wey oda users dey read well well
3. Ken Nnamani - South East
Di Nigerian politician wey be from Enugu state, na di former Presido of di Nigeria Senate from 2005 to 2007.
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post
4. Stella Okotete - Women Rep
Madam Okotete na di Executive Director of di Nigeria Export Import Bank and also di founder of E'Girls Right Foundation.
5. Govnor Sani Bello - North Central
Di politician wey pipo sabi as Lolo na di current Govnor of Niger State, north central of di kontri. Im don dey lead di state since 2015.
6. Dr. James Lalu - physically challenged
7. Sen. Abubakar Yusuf - Senatè Rep
Di APC member of Senate dey represent di constituency of Taraba Central since 2015.
8. Hon. Akinyemi Olaide - Reps
9. David Lyon - South South
David Lyon Perewonrimi na di former Governorship candidate of di APC for Bayelsa state. Dem bin declare am winner of di election but one day to im swearing-in, Supreme court cancel im victory onto say im running mate Degi Wangagra submit fake certificate to INEC.
10. Abba Ari -North West
11. Prof. Tahir Mamman - North East
12. Ismail Ahmed - Youth
13. Sen. Akpan Udoedehe- Secretary
Di Akwa Ibom politician na di former Minister of State for di Federal Capital Territory.

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Acting National Chairman of di party Victor Giadom na im call for dis meeting and President Muhammadu Buhari also attend di meeting inside Abuja.
Shortly afta di meeting, Giadom reaction be say "my take on di outcome of today APC NEC meeting be say: I bin don earlier say di collective decision of di entire NEC go prevail inside today meeting. I also promise to stand by any decision wey dem decide.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Di new party chairmo wey be oga Buni go organize national convention to elect new national officers of di goment party.













