Bassirou Faye officially na Senegal youngest president

Senegal President, Bassirou Diomaye Faye for middle of im two wives

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Senegal President, Bassirou Diomaye Faye for middle of im two wives

Bassirou Diomaye Faye, Senegal fifth president, don dey sworn into office for one ceremony in di capital, Dakar.

Last month, 44-year-old Mr Faye bin win di delayed elections, e gbab 54% of di vote, ahead of im main challenger Amadou Ba.

On Friday, di kontri Constitutional Council confam Oga Faye as di winner.

Heads of state from around di continent attend di inauguration ceremony, including Nigeria President Bola Tinubu, who also be chair of di regional bloc, Ecowas.

During di inauguration, Senegal president, Faye Diomaye take im oath as im swear bifor God say im go dey faithful and fulfil di promises of im office as president towards di pipo.

Bassirou Diomaye Faye thank God, all di dignitaries wey attend and im family for dia unwavering support.

“Bifor God and bifor di Senegalese nation, I swear to faithfully fulfil di office of President of di Republic of Senegal, to observe as well as to conscientiously abide by di provisions of di constitution and di laws.

To devote all my power to defend di constitutional institutions, di integrity of di territory, national independence and to spare no effort to achieve African unity," Faye tok as e take oath for di Diamniadio near di capital of Senegal Dakar.

Expectations dey high for di Senegalese pipo as dem inaugurate di new president

Dis na Senegal fifth president since di kontri don gain independence na di fourth democratic transfer of power.

Expectations dey high as young Bassirou Diomaye Faye mount di stage as di president wey dem just swear in for Senegal.

Di new president afta im take oath, promise say im go fight corruption, reform di economy and prioritise national interest.

Di president also admit di efforts of di past leaders of di kontri for dia effort for independence, liberty, justice and rule of law wey Senegalese pipo dey enjoy today.

“I promise to govern wit humility and transparency, and to fight corruption for all levels,” Diomaye Faye tok.

E promise to carefully observe di provisions of di constitution and di laws” and defend “di integrity of di territory and national independence and spare no effort to achieve African unity.

Senegalese president tok say im go fight insecurity for Africa while im employ oda Africa leaders make dem join am base on di common aspirations, sovereignty, development and well-being of Africa.

Im add say im dey committed to strengthen efforts wey dem go deploy for peace, stability and Security for Africa.

Faye tok say under im goment Senegal go be kontri of hope, peace, strengthen democracy wit independent justice system go get strength.

E tok say im go remember di sacrifice of di pipo towards im presidency as dem fight for im freedom.

“I dey sabi say results of di elections voice great desire for systemic change," e tok.

Fotos of Bassirou Diomaye Faye and some African leaders wey attend di event

Foto of Bassirou Faye and President Bola Tinubu during Faye'sInauguration

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Bassirou Diomaye Faye and Nigeria president , Bola Ahmed Tinubu pose for foto afta im swearing in as Senegal President.
Foto of Bassirou Faye and President Mamady Doumbouya during Faye'sInauguration

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Bassirou Diomaye Faye and President of di Republic of Guinea, Mamady Doumbouya pose for foto afta im swearing in as Senegal President.
Foto of Bassirou Faye and President Adama Barrow during Faye'sInauguration

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Bassirou Diomaye Faye and President of di Republic of di Gambia, Adama Barrow pose for foto afta im swearing in as Senegal President.
Foto of Bassirou Faye and President Nana Akufo-Addo during Faye'sInauguration

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Bassirou Diomaye Faye and President of Ghana, Nana Akufo-Addo pose for foto afta im swearing in as Senegal President.
Foto of Bassirou Faye and President Jose Neves during Faye'sInauguration

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Bassirou Diomaye Faye and President of Cape-Cape-Verde, Jose Neves pose for foto afta im swearing in as Senegal President.
Foto of Bassirou Diomaye Faye taking im oath of office as Senegal president

Wia dis foto come from, Bassirou Diomaye Faye/X

Bassirou Faye Inauguration

Wia dis foto come from, Getty Images

Bassirou Faye Inauguration

Wia dis foto come from, Getty Images

Bassirou Faye Inauguration

Wia dis foto come from, Getty Images