Why hair loss dey happun and how you fit stop am

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Ameer Ahmed
- Role, BBC World Service
- Read am in 5 mins
Anybodi fit lose hair, e no mata weda you be man or woman, young or old, or which tribe you come from.
Hair fit begin fall for many reasons like your family gene, medical wahala, old age or even di kind lifestyle wey you dey live.
To help us understand beta why hair dey fall and wetin fit be solution, we tok to Enitan Agidee, wey be clinical director trichologist wey dey stay for UK. She dey see different kain clients, but most of dem na women dem be, wey get afro-textured hair.
"No one dey free from hair loss, even me wey sabi plenty about hair, even me sef I don experience hair loss bifor," she tok.
One US journal, Dermatologic Surgery report say 16% of men wey dey between 18 - 29 years don experience hair loss. Di number don rise to 30% for men wey dey 30-39 years, and more dan half of men wey dey between 40-49 years dey lose hair.
Hair loss (wey doctors dey call alopecia) dey get more attention for men, and e dey common for women too and dem also dey lose dia hair.
According to Harvard Medical School, about one third of women dey experience hair loss for one point for dia life.

Wia dis foto come from, Getty Images
You fit reverse early hair loss?
Di first tin wey pesin suppose do na to get proper diagnosis from professional dermatologist, Dr Aanchal Panth tok, sake of say e get many changes wey you fit make for your daily lifestyle.
End of Di one wey oda users dey read well well
"High protein diet dey veri important for beta hair growth. If bodi dey lack any nutrient, na dat one dem suppose treat first."
Many pipo wey notice say dia hair dey fall sharp-sharp go begin use cream or product wey get chemical like minoxidil or caffeine.
Minoxidil dey mostly come as liquid or foam format. Research show say e dey help increase blood flow go hair root, wey fit help hair grow longer.
However, Dr Panth warn say minoxidil "fit help reduce hair thinning, but e no go grow new hair".
For men especially, dem dey use ketoconazole join to help control dia hair loss. Experts tok say e also dey help treat dandruff, becos dandruff wey dey cause inflammation fit even make hair loss worse.
Ketoconazole dey different wit minoxidil - na antifungal medicine wey dem dey use treat scalp infection. Some studies even tok say e fit help reduce DHT, one hormone wey dem link to hair loss.
"A lot of pipo dey tink say hair loss na somtin you fit treat, and di hair go grow and dat na all, but no be so. To reverse hair loss na like lifetime commitment," Dr Panth tok.

Wia dis foto come from, Getty Images
Lifestyle changes
Education about your hair type dey veri important.
Trichologist Agidee wey sabi afro hair well well tok say some kain hairstyle like tight, heavy braids and heat style, fit cause early hair loss.
"Make you enjoy your hair, but you need understand say wen you dey do hairstyle wey tight or heavy, e dey put plenty pressure for your hair follicles."
And di hair follicles dey make hair grow, but dem still dey help wound healing and skin regeneration for your scalp.
"I don see some clients wey combine both traction alopecia and anoda condition wey dem dey call frontal fibrosing alopecia, and na over-styling cause am."
Oda tins wey fit make hair loss worse na smoking, alcohol, stress and lack of sleep.
Dr Panth say smoking dey cause one condition wey dem dey call vasoconstriction wey dey reduce blood flow go your organs, and e dey affect your scalp too.
If you no dey wash your scalp regularly, e fit also make you lose your hair, you fit even notice hair dey fall wen you dey baff, if you no dey shampoo am.
Dr Panth advise say, "If you be pesin wey get oily scalp, you fit wash your hair evri day or evri oda day."
If your scalp and hair type dey normal or dry, she tok say make you wash am at least three times evri week.

Wia dis foto come from, Getty Images
Hair transplant na di easiest solution?
Hair transplant na cosmetic procedure wey involve surgery, many pipo dey do am to feel beta and confident about how dem look.
Even though e dey cost plenty money, hair transplant still dey popular sake of say e fit give you di best visual result, Dr Panth tok
But she tok say wetin pipo no dey always understand be say, if you do hair transplant and you no continue to dey treat your hair, afta like five to six years, your natural hair fit begin fall, and na only di transplanted hair go remain.
Trichologist Enitan Agidee believe say hair transplant suppose be your last option, say e no be solution for evribodi wey dey lose hair.
"Transplant be like say you dey go outside wey cold, and instead of you to wear sweater inside, you just wear jacket…
"After some time, cold go still catch you."














