Wetin dey inside di Oronsaye report wey Tinubu approve for 'full implementation'

Wia dis foto come from, Presidency
Nigeria President Bola Tinubu don approve di full implementation of di Stephen Oronsaye Panel report.
Di decision come from di Federal Executive Council, FEC, meeting wey President Tinubu preside over on Monday, 26 February for di State House Abuja.
Di 2012 Stephen Oronsaye report bin recommend merging, scraping and relocation of some parastatals and agencies to cut cost of governance
Afta di FEC meeting, officials release statement say dem don decide to implement di recommendations of di Steve Oronsaye panel on restructuring and rationalisation of federal agencies, parastatals and commissions, in order to support efficiency for di federal service and reduce di cost of governance.
For one statement wey Special Adviser Information and Strategy to President Tinubu, Bayo Onanuga post on X, e say di Tinubu administration don decide to face di monster of high governance cost by implementing elements of di report.
E say di implementation go involve merging, subsuming and scrapping of agencies wey dey perform similar functions.
"Di president don set up one eight-man committee to ensure say di necessary legislative amendments and administrative restructuring dem need to implement di reforms dey effected.
Pipo wey dey di committee include di Secretary to di Government of di Federation, Head of Civil Service, Attorney General of di Federation, Budget and Planning Minister, DG Bureau of Public Service Reform and di Special Assistant to di president on National Assembly. Di Cabinet Affairs Office go serve as di secretariat." Oga Onanuga tok for di statement.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Presidency/X
Key tins to sabi about di Stephen Oronsaye Panel report
For 2011, former Nigeria President, Goodluck Jonathan bin set up di Presidential Committee on Restructuring and Rationalisation of Federal Government Parastatals, Commissions and Agencies, under di leadership of former Head of Civil Service, Stephen Oronsaye.
Di Presidential Committee get di following members - Stephen Oronsaye, Chairman; Japh CT Nwosu, Member; Rabiu D. Abubakar, Member; N. Salman Mann, Member; Hamza A. Tahir, Member; Adetunji Adesunkanmi, Member and Umar A. Mohammed, Member.
For April 2012, di committee submit one 800-page report, wey establish say na 541 Federal Government parastatals, commissions and agencies (statutory and non-statutory) dey.
Di report reveal high level of competition among dis several agencies wey dey perform similar roles, and dis no only dey create unhealthy rivalry among dem but e also bring about unnecessary wastage in government expenditure.
Di panel bin recommend say make government reduce 263 of di statutory agencies go 161, scrap 38 agencies, and merge 14 agencies to departments for ministries.
Di panel also recommend di discontinuation of government funding for professional bodies and councils. Dem say dis measures go free funds for di much-needed capital projects across di kontri.
Former President Goodluck Jonathan no implement di report but for March 2014, e set up one White Paper Drafting Committee wey di den Attorney-General of di Federation and Minister of Justice, Mohammed Adoke head to study di recommendations and produce a White Paper on di report.
President Bola Tinubu wen e assume office for 2023, bin notify professional bodies and councils say dem go stop to dey fund dem beginning from di 2024 budget in line wit di decisions of di Presidential Committee on Salaries (PCS).
“I wish to inform you say di presidential committee on salaries (PCS) for dia13th meeting don approve di discontinuation of budgetary allocation to professional Bodies/Councils effective 1st January, 2024. You will be required, effective 1st January 2024, to be fully responsible for your personnel, overhead and capital expenditures.” E tok.

Wia dis foto come from, Budgit/X
Meanwhile, wen di immediate-past President Muhammadu Buhari step into power for 2015, e promise say im go implement di recommendations on di Oronsaye report.
Buhari Administration bin establish di Bukar Aji Committee to review di White Paper wey di Whitepaper Committee wey Goodluck Jonathan administration prepare.
For April 2020, The Cable bin report say President Muhammadu Buhari don approve di implementation of di report.
Di den minister of finance, budget and national planning, Zainab Ahmed bin tell tori pipo afta one Federal Executive Council Meeting say dem don forward di president approval to di head of civil service plus to di secretary to di government of di federation.
“Di president don approve dat dis administration go implement di Oronsaye report.
“Dis na report wey don dey in place for a long time but den no implementation but di president don approve am say dem must implement am and we don send Mr President approval go di arms of government wey dey responsible for dis and dat na di office of di head of di secretary to di government of di federation and di head of di civil service.” Ahmed tok.
As at di time dem submit di Oronsaye report, na 541 government parastatals, commissions and agencies (statutory and non-statutory) dey for di kontri, but now e don increase.
At present, di number of federal agencies, commissions and parastatals don increase and e dey estimated to dey close to 1000, according to one report by The Cable.
Complete list of agencies, commissions and parastatals wey dey affected

Wia dis foto come from, Presidency/X
AGENCIES WEY DEM GO SCRAP
- Government go scrap di Pension Transitional Arrangement Directorate and transfer dia functions go di Federal Ministry of Finance
- Dem go scrap di National Senior Secondary Education Commission (NSSEC) and transfer dia functions go di department of Basic and Secondary Education for Federal Ministry of Education.
AGENCIES WEY DEM GO MERGE
- National Agency for di Control of Aids (NACA) go dey merged under di Centre for Disease Control for Federal Ministry of Health.
- National Emergency Agency (NEMA) go dey merged wit National Commission Refugee, Migration and Internally Displaced persons [NCFRMI].
- Directorate of Technical Cooperation for Africa (DTCA) go dey merged wit Directorate of Technical Aid (DTAC) and go function as a department for di Ministry of Foreign Affairs.
- Infrastructure Concession and Regulatory Commission (ICRC) go dey merged wit Bureau for Public Enterprise (BPE).
- Nigerian Investment Promotion Commission (NIPC) go dey merged wit Nigerian Export Promotion Council (NEPC).
- National Agency for Science and Engineering Infrastructure (NASENI) go dey merged wit National Centre for Agriculture Mechanization (NCAM) and Project Development Institute (PRODA).
- National Biotechnology Development Agency (NABDA) go dey merged wit National Centre for Genetic Resources and Biotechnology (NACGRAB).
- National Institute for Leather Science Technology (NILEST) go dey merged wit National Institute for Chemical Technology (NARICT).
- Di Nomadic Education Commission (NEC) go dey merged wit National Commission for Mass Literacy, Adult Education and Non Formal Education.
- Federal Radio Corporation (FRCN) go dey merged wit Voice of Nigeria (VON)
- Di National Commission for Museums and Monuments go dey merged wit National gallery of Arts.
- Di National Theatre go dey merged wit National Troupe of Nigeria.
- Di National Metallurgical Development Centre (NMDC) go dey merged wit National Metallurgical Training Institute (NMTI).
- Dem go join Nigerian Army University (NAUB) wit Nigerian Defence Academy (NDA)
- Airforce Institute of Technology (AFIT) go dey merged wit Nigerian Defence Academy (NDA)
Agencies wey go dey under odas
- Service Compact wit all Nigerians (SERVICOM) go dey function as a department under Bureau for Public Service Reforms (BPSR).
- Border Communities Development Agency (BCDA) go dey function as a department under di National Boundary Commission (NBC).
- National Salaries, Income and Wages Commissioned (NSIWC) go dey under Revenue Mobilization & Fiscal Allocation Commission (RMAFC).
- Institute for Peace and Conflict Resolution go dey subsumed under Nigerian Institute of International Affairs (NIIA)
- Public Complaints Commission (PCC) go dey subsumed under National Human Rights Commission (NHRC).
- Nigerian Institute for Trypanosomiasis (NITR) go dey subsumed into Institute of Veterinary Research (VOM).
- Nigerian Natural Medicine Development Agency (NNMDA) go dey subsumed under di National Institute of Pharmaceutical Research and Development (NIPRD).
- National Intelligence Agency Pension Commission go dey subsumed under di administration of Nigerian Pension Commission (PenCom).
- Di Nigerian Film and Video Censors Board (NFVCB) go dey subsumed as a department for di Ministry of Arts, Culture and Creative Economy.
AGENCIES DEM GO RELOCATE
- Dem go relocate Niger Delta Powerholding Company (NDHC) go Ministry of power.
- Dem go relocate National Agricultural Land Development Agency [NALDA] go di Federal Ministry of Agriculture and Food Security
- Dem go convert National Blood Service Commission to Agency and relocate am go di Federal Ministry of Health
- Dem go convert Nigerians in Diaspora Commission (NIDCOM) to Agency and transfer am go di Ministry of Foreign Affairs.











