How phone call wey leak stop di Thai PM career - and di Shinawatra dynasty

Suspended prime minister of Thailand Paetongtarn Shinawatra arrive for one press conference in Bangkok on July 1, 2025. She dey smile as she walk through di doorway in one dark green blazer wey she wear ova one white shirt and white and blue floral skirt.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Paetongtarn Shinawatra
    • Author, Jonathan Head
    • Role, South East Asia correspondent in Bangkok
  • Read am in 5 mins

Thailand Constitutional Court don strike again, as dem comot anoda prime minister from office.

Di kontri nine panel of judges rule say Paetongtarn Shinawatra violate ethical standards for one phone call she make for June wit di veteran Cambodian leader Hun Sen, wey later leak.

Inside di audio, Paetongtarn dey friendly towards Hun Sen ova dia kontri border dispute, and criticise one of her own army commanders.

She defend her conversation saying she dey try make diplomatic breakthrough wit Hun Sen, old friend of her papa Thaksin Shinawatra, and she tok say di conversation suppose don remain confidential.

Di leak dey damaging and deeply embarrassing for her and her Pheu Thai party. E cause dem to call for her to resign as her biggest coalition partner walk out of di govment, leaving her wit slim majority.

In July, seven out of di nine judges on di court vote to suspend Paetongtarn, one margin wey suggest say she go suffer di same fate as her four predecessors. So Friday decision no dey surprising.

Paetongtarn na di fifth Thai prime minister wey dem remove from office through di court, all of dem from administration dey backed by her father.

Dis don cause widespread belief in Thailand say e dey always rules against pipo wey dem see as threat by conservative, royalist forces.

Di court don also ban 112 political parties, many of dem small, but include two previous incarnations of Thaksin Pheu Thai party, and Move Forward, di reformist movement don win di last election in 2023.

For few oda kontris political life dey monitored by one branch of di judiciary.

Smiling Paetongtarn Shinawatra turn to her papa and former Thai Prime Minister Thaksin Shinawatra as she fold her hands as gesture of respect.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Paetongtarn Shinawatra wit her papa Thaksin

For dis case, na di phone conversation wey leak seal Pateongtarn fate.

E no clear why Hun Sen choose to burn im friendship wit di Shinawatra family. E react angrily to one comment by Paetongtarn calling Cambodian leadership use of social media to push dia arguments "unprofessional".

Hun Sen describe am as "an unprecedented insult", wey don drive am "tok true".

But im decision cause one political crisis for Thailand, causing tension ova dia border, e turn into five-day war wey kill more dan 40 pipo last month.

Di Thai constitution now require members of parliament to choose one new prime minister from di very limited list.

Each party dey required to name three candidates bifor di last election, and Pheu Thai don use up two, afta di court dismissal of Srettha Thavisin last year.

Di third candidate, Chaikasem Nitisiri, na former minister and party stalwart, but e get little public profile and e dey in poor health condition. Di alternative go be Anutin Charnvirakul, di former interior minister wey Bhumjaithai party walk out of di ruling coalition, becos of di leaked phone call.

Relations between di two parties no dey smooth again, and Anutin go need to rely on Pheu Thai, wey get many more seats, to form one govment.

Di largest party in parliament, di 143 MPs wey bin dey di formerly dissolved Move Forward and dem don reform as Di People Party, don vow dem no go join any coalition, but dem go remain for opposition until dem hold di new election.

Di new election na di only way out of di current political mess, but Pheu Thai no want dat. Afta two years for office, e neva meet dia promises to revive di economy.

One monitor show Paetongtarn Shinawatra during di proceedings at di Constitutional Court for Bangkok on August 21, 2025. She look glum and she dey wear one black suit.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Paetongtarn during di proceedings for di Constitutional Court earlier in August

For all of her youth, di inexperienced Paetongtarn fail to establish any real authority ova di kontri, wit most Thais presuming say na her papa dey make all di big decisions.

But Thaksin Shinawatra don lose im magic touch. Pheu Thai party signature policy at di last election, one plan digital wallet to put B10,000 ($308; £178) inside pocket of every Thai adult, don stop, and pipo dey criticise am as ineffective.

Oda big plans, to legalise casinos, and to build "land-bridge" linking di Indian and Pacific Oceans, no go any wia.

At di time wen dem don fire up Thai nationalist sentiment ova di border war wit Cambodia, di Shinawatra family long-standing – though now broken – friendship wih Hun Sen don raise di suspicion in conservative circles say dem go always put dia business interests bifor di nation.

Di party popularity don drop, and e dey likely to lose many of di 140 seats for di next election now.

For more dan two decades di party na unbeatable electoral force wey dominate Thai politics.

E go dey hard for dem to ever regain dat dominance.