Eviritin you need to know about Grammy Awards 2025

Nigerian Afrobeat stars Burna Boy, Tems, Davido, Yemi Alade & Wizkid,

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 4 mins

Di biggest music show for di world go happun dis weekend for America.

Di Grammy Awards 2025 go showcase some ogbonge stars for di music industry from Afrobeat, pop, rock and hip-hop.

Nigeria artistes dominate di Best African Music Performance category wit di likes of Yemi Alade, Asake, Wizkid Burnaboy, Davido, Tems and Rema all collect nomination.

Organisers go hand out 94 awards, dem go recognise eviritin from best pop album to best choral performance.

Beyoncé and Taylor Swift don confam say dem go attend di event, di two singers go dig am out for di album of di year category for di first time since 2010 (Swift bin win on dat occasion, fact fans).

Dis na all you need sabi about di 67th Grammy Awards ceremony wey go happun on Sunday.

Best African Music Performance

  • Tomorrow - Yemi Alade
  • MMS - Asake & Wizkid
  • Sensational - Chris Brown ft Davido & Lojay
  • Higher - Burna Boy
  • Love Me Jeje - Tems

When be di 2025 Grammy Awards?

Di 2025 Grammy Awards go take place on Sunday, 2 February 2025.

Na for di Crypto.com Arena for Los Angeles na im di 67th Grammy Awards ceremony go take place.

Trevor Noah wey from South Africana go host dis year awards again for di fifth consecutive year.

What time be 2025 Grammy Awards & how to watch for Nigeria?

For now e no dey clear which station go broadcast di ceremony live for Nigeria.

Tori be say di ceremony go begin by 2am WAT for early mor-mor on Monday (3 February).

Na around dat kain 5:30am WAT dem go give di final trophy.

Who dey perform for di Grammys 2025?

Shakira on stage for one short red and yellow dress wit shoulder straps

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Shakira go perform for dis year Grammy
  • Benson Boone
  • Sabrina Carpenter
  • Jacob Collier
  • Sheryl Crow
  • Billie Eilish
  • Cynthia Erivo
  • Chappell Roan
  • Charli XCX
  • Doechii
  • Herbie Hancock
  • Brittany Howard
  • John Legend
  • Chris Martin
  • Janelle Monáe
  • Brad Paisley
  • Raye
  • Shakira
  • Teddy Swims
  • Lainey Wilson
  • Stevie Wonder
  • St. Vincent

Who dey vote for di Grammys?

Wide shot of di 2025 Grammy stage, e show di giant LED screens and 20-foot golden sculpture wey dey inspired by a Gramophone machine.

Wia dis foto come from, Yellow Studio New York

Wetin we call dis foto, Dis year stage, na Yellow Studio design am, e feature one giant 20-foot sculpture, wey dey inspired by di "brass horn" of di gramophone for Grammy Award.

More dan 13,000 members of di Recording Academy, na dem dey vote for di Grammys every year - including musicians, producers, lyricists, and even di pipo wey dey write CD liner notes.

To qualify, dem must dey work currently for di music industry, and dey pay an annual subscription of $150 (£120). All former winners also dey eligible to vote.

Every member dey allowed to vote in up to 10 categories across three fields, like rock, classical and R&B. Dem dey encourage dem to only vote for genres wia dem sabi well-well.

Additionally, every member, regardless of dia background, go vote for di six biggest awards of di night. Dis na album of di year, record of di year, song of di year, best new artist, songwriter of di year and producer of di year.

Di 2025 awards recognise music wey dem release between 16 September 2023 and 30 August, 2024. Dem no dey reveal di winners until di ceremony.

How di California wildfires affect di ceremony?

E affect am well-well oh.

All di serenren wey dey surround di Grammys no go dey. No pre-parties, no after-parties. Eviritin dem cancel am except di ceremony itself. All di money wey dem for spend on champagne and vol au vents dem carry put inside relief efforts.

Di Recording Academy and dia affiliated MusiCares charity don also set up a Fire Relief fund, wey so far don pledge more dan $3.2 million (£2.6 million) in emergency aid to assist music professionals wey dey affected by di fires.

And di telecast itself go reflect di devastation, wit segments wey go honour di first responders wey risk dia lives to tackle di fire and protect di vulnerable.

"We go still get performances, we go still get di awards and honour music," Recording Academy CEO Harvey Mason, Jr tell Variety magazine.

"But you go know say something happun, and you go know say we dey use music to do good."