Di Harris-Cheney show go fit shake anti-Trump Republicans?

Harris and Cheney sat together in a hall in Royal Oak, Michigan

Wia dis foto come from, Getty Images

    • Author, Anthony Zurcher
    • Role, North America correspondent, Michigan, Wisconsin and Pennsylvania
  • Read am in 4 mins

Kamala Harris spend di full Monday to pitch directly to di independent and Republican voters wey di three states wey form wetin dem dey call di Democratic Party "blue wall".

Two weeks bifor di election, Harris don enta Pensylvania, Michigan and Wisconsin togeda wit outspoken anti-Trump Republican.

Even though e no dey surprising say Harris go enta di hotly contested battlegrounds of di campaign as e don almost finish, but she no do her normal rally-style events.

Instead of dat, she decide say she go do "town hall" format togeda wit Cheney. She carry am do discussion wit pipo wey go meet di idea of reaching across di divide.

Dem follow Republican pollster and publisher Sarah Longwell tok for Pennsylvania and conservative commentator Charlie Sykes for Wisconsin.

Di third moderator na Maria Shriver from Michigan wey be niece of JFK and former first lady of California under di Republican Govnor Arnold Schwarzenegger.

No be just boju-boju dem take pick di locations wey be counties wey dey outside di state largest cities dem.

Dem dey rich, di kain wey dey college-educated, and traditionally Republican wey dey move towards Democrats even though some blue-collar voters don dey move from di party.

Dis na sign of how di joinbodies wey dey support di two main party dey change for di era of Donald Trump.

Craig Synder wey be Republican strategist from Pennsylvania tok say di Democrats dey try to reach Republicans but to hear from Democrats no dey enof.

E say, "dis voters wan hear from oda Republicans. Dem wan know say no be only dem waka come."

For di three states, Liz Cheney wey co-chair di congressional committee wey investigate di 6 January attack for US Capitol and wey one Trump backed challenger pursue from office for 2022, na di pesin wit di message.

Cheney tok for Michigan say, "you fit vote wit your conscience and no tell anybodi anytin. And dem go be millions of Republicans wey go do am."

Banner saying 'More on US election 2024' with faces of Harris and Trump

Harris add say she don see Republicans wey meet Cheney and thank am say she dey tok against di former presiden even though dem no go tok am outside.

Harris say, "from wia I dey stand, she no dey alone".

Tori be say di crowds for di venue bin dey full of Republicans and voters wey neva decide. Even though di kwesions bin dey pre-selected and di audience response, di way dem dey nod and shock wen di tori of Trump political wuru-wuru waka comot, suggest say most of dem dey friendly.

Dan Voboril wey be retired teacher from Wisconsin bin dey worry about di toxic nature of Trump Republican Party. E tok say im bin no sabi who e go vote for but dey consider Harris.

Cheney tok say di party no dey more important dan say make di pesin wey be president be pesin of character and principles.

She add say, "if you no go employ pesin make e babysit your pikin, den make you no make dat pesin to be president of di United States".

Man in polling booth

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Early voting for Florida

Most of di questions wey pipo ask for dis three state town hall trip, be like say dem ask am so Harris go fit tok about her main campaign toking points.

One young mama for Pennsylvania ask how she go take care of her old mama wey get dementia.

Harris tok about her plan for goment supported in-home nursing care. For Michigan, dem ask about Ukraine wey make both Cheney and Harris to chook mouth say if Trump win, mean say Vladimir Putin go "siddon for Kyiv".

Di approach to di war wey Trump and im running mate JD Vance get don enta many Americans bodi wella. Dis Americans dem believe say di billions of dollars wey dem don spend to aid Ukraine since Russia invade dem, dem suppose use di money for house.

Evri stop wey Harris-Cheney day tour get kwesion on abortion and reproductive rights wey allow Cheney, wey be anti-abortion to tok say di Republican states wey ban di procedure go too far.

As at now, opinion polls show say di race for presidency dey neck-and neck, nationally and for di blue wall battleground states.

For 2016, Donald Trump win di three traditionally Democratic “rust belt” states. Dem bin dey for di heart of American manufacturing industry but for 2020, Joe Biden win dem back.

Most surveys show say di amount of Republicans wey dey back Democrats dey less than 10%.

If Cheney dey right and Republicans dey wey dey hide mouth wey go comot vote Democratic - Harris road to di White House go smooth di more.

Las-las, di Harris campaign dey reason sat any chance to slowly comot Trump support wey e no strong dey worth di day work.