‘No matter what Nigeria no go give in to wicked pipo’ – President Buhari tok as im mourn death of Ondo worshippers

President Buhari

Wia dis foto come from, Femi Adesina/Facebook

Nigeria President Muhammadu Buhari don condemn di killing of worshippers of St Francis Catholic Church, Owo Kingdom for Ondo State.

Di President say na only wicked pipo from di underworld fit don think and carry out dat kind wicked act.

For inside statement Buhari say: “No matter what, dis kontri [Nigeria] no go ever give in to evil and wicked pipo, and darkness no go ever overcome light. Nigeria go eventually win.”

Di President wey say im mourn di dead condole wit di families of di Catholic Church and di state goment as im charge emergency agencies to take action.

Im statement dey come hours afta gunmen in large numbers invade di church wey dey southwest Nigeria while worship service bin still dey in session.

"Dem shoot congregants, kill some and den kidnap odas," eyewitness tell BBC Pidgin.

Videos wey BBC Pidgin don use eye see show say pipo injure while odas die but e no dey clear yet as to how many.

Cases of violence by armed groups don increase for Nigeria.

Exactly one week ago di head of di Methodist Church for Nigeria, suffer abduction along wit two other clerics for di southeast of di kontri.

Di Methodist prelate say im pay about $240,000 to gain im freedom togeda wit odas.

On 5 June 2022, mob set one vigilante ablaze for di kontri capital, Abuja on allegations say im commit blasphemy.

Police tok wetin preliminary investigation show

St Francis Church
Wetin we call dis foto, Di incident throw di town into panic as many pipo begin troop to di church to see wetin happun

Di state police command for dia preliminary investigation reveal say, "di assailants approach di church during service come begin shoot from outside di church while odas wey reach four in number shoot directly into di church".

Odunlami Funmilayo wey be di state tok-tok pesin add say: "di state police commissioner don order immediate deployment of armed and specialised policemen to di area to restore normalcy and fortify di entire community."

Meanwhile, di CP don also order forensic investigation into di attack.

Ondo State governor Akeredolu visit Owo Kingdom

Rotimi Akeredolu

Wia dis foto come from, Ondo State Government

Wetin we call dis foto, Governor of di state, Akeredolu (L) don vow to hunt down di pipo wey carry out di attack and make dem pay.

Governor of Ondo state Rotimi Akeredolu don tok say im dey deeply sad by di unprovoked attack and killing of innocent pipo of Owo, wey dey worship for St. Francis Catholic Church.

For im social media handle di governor say: "di vile & satanic attack na calculated assault on di peace-loving pipo of Owo Kingdom wey don enjoy relative peace for years."

Di governor wey bin dey Abuja don visit di church wia di attack happun.

Owo, na di hometown of Akeredolu.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Wetin di Catholic Diocese of Ondo tok?

St Francis Church
Wetin we call dis foto, Photo from inside St Francis Xavier Catholic Church

Meanwhile di Catholic Diocese of Ondo for say dem never sabi di identity of di gunmen wey attack di worship centre early Sunday.

For statement dia tok-tok pesin Rev father Augustine Ikwu sign, dem say "di incident wia many pipo die, odas injure and di church dey violated happun for time wen holy mass dey go on."

Dem say security agencies don dey deployed to di community so dem go fit handle di situation, dem pray for God intervention to bring back peace and calm.

Di Catholic Diocese add say all di priests and Bishop for di parish dey safe and non of dem dey kidnapped.

Dem urge Nigerians to pray for Owo pipo and di state at large.

Worshippers carry injured
Wetin we call dis foto, Worshippers help carry pipo wey injure

Leader of St Francis Church, Father Andrew Abayomi wey bin dey wen e happun tell BBC say as dem dey try end church service wen im tell pipo to dey go house na den dem begin hear dynamite explosion and gunshots come follow.

Andrew Abayomi say “I bin tok say make pipo no comot say make dem hide for inside church but you know say some pipo go wan comot.

“Dis tin wey we dey tok reach five to twenty minutes, we hear say dem don go, na den we come outside begin carry pipo go hospital."