Super Eagles return to training for 2026 World Cup Africa qualifying play-offs afta 'settlement'

Players of di Super Eagles warm up during di 2026 Fifa World Cup Qualifing match between Nigeria Super Eagles and Rwanda Amavubi, wey Nigeria win 1-0, for di Godswill Akpabio Stadium.

Wia dis foto come from, NurPhoto via Getty Images

Wetin we call dis foto, Nigeria Super Eagles dey warm up ahead of dia match against Rwanda for di 2026 Fifa World Cup qulaifying match for Uyo, Akawibom State, South-south, Nigeria.
Read am in 3 mins

Nigeria Super Eagles train on Wednesday 12 November, 2025 afta di Nigeria Football Federation 'resolve issues' wit di players.

Di team wey bin boycott dia training session on Tuesday sake of unpaid bonuses and allowances do tok-tok wit di football body and dem get to put di football and di kontri first bifor any oda tin.

Nigeria go face Gabon on Thursday for dia first game for di 2026 Africa World Cup qualifying play-offs.

Tori be say di three-time Africa Cup of Nations champions boycott dia training sake of dia bonuses and allowances wey authorities dey owe dem.

Sports journalist Oluwashina Okeleji post for im X handle say "2026 World Cup playoff: Nigeria players and officials boycott training sake of bonus mata.

But di captain of Super Eagles later confam say di team don resolve dia mata.

William Troost-Ekong for im X handle say "Issue resolved. Outstanding financials cleared and on ground.

E add say di team dey and focussed as before on representing Nigeria wit our maximum for di games ahead!"

What about di game against Gabon?

Dis action fit affect dia game against Gabon and e fit put dia chances to qualify for di World Cup at risk.

Na hours remain for di Super Eagles to face dia opponent Gabon for di 2026 Fifa World Cup Africa Qualifying Play-offs and dis kain kasala dey hapun.

Almost all di players don land for Rabat, Morocco wia di play-offs go happun except Maduka Okoye wey dem dey wait to arrive.

Nigeria go face Gabon on Thursday for dia first match of di play-offs.

Oda times national football teams protest unpaid allowances

For June 2019 for Egypt, Nigeria Super Eagles bin threaten to boycott training sake of govment no gree pay dem dia bonus.

But di Nigeria Super Eagles bin return to training afta dem beat Guinea 1-0.

Di players bin no attend training dat Wednesday evening, and e make di NFF to act immediately so dem go fit prevent anoda strike before di match against Zambia wey bin dey come up dat Friday.

"Di players don refuse to leave dia hotel for Casablanca sake of unpaid bonuses," one top NFF official tell BBC Sport Africa.

"Issue also dey sake of unpaid first five days of camp, wey di players expect in dia bank accounts but e neva arrive."

Di NFF, wey dey receive dia funding from di Nigerian govment make $1,000 payment to each player sharp-sharp to cover dia 10 days' allowance.

NFF President Amaju Pinnick tell BBC Sport Africa dat time say im organisation dey "deal wit di issue" - but funds go get to come from di kontri Sports Ministry before dem go fit make any payment.