Dem don assassinate candidate for Ecuador presidential election Fernando Villavicencio

Wia dis foto come from, Reuters
Dem don shoot and kill one candidate for di forthcoming Ecuador presidential election for one campaign rally.
Fernando Villavicencio, a member of di country national assembly, dey come under attack afta e leave di event for northern city of Quito on Wednesday.
A member of im campaign team tell local media say Oga Villavicencio just dey wan enta im motor when one man waka near am and shoot am for head.
Current president Guillermo Lasso vow say di "crime no go go unpunished".
Witnesses say di man shoot Oga Villavicencio, wey be 59 years, three times.
Di suspect also collect bullets during an exchange of gun fire wit security and later die from im injuries, di kontri attorney general tok on social media.
Dem add say pipo suffer injuries, including one candidate for assembly and two police officers.
Di first round of di presidential election dey scheduled to take place on 20 August.
End of Di one wey oda users dey read well well
Oga Lasso, wey no go dey on di ballot, say im dey "outraged and shocked" by di killing, adding: "Organised crime don come a long way, but di full weight of di law go fall on dem."

Wia dis foto come from, Reuters
A recent rise in violent crime, wey di growing presence of drug cartels for Ecuador cause, don become di main issue for dis year presidential campaign.
Last month, Oga Lasso declare states of emergency and night curfews for three provinces sake of a number of killings linked to organised crime.
As well as security, Villavicencio campaign don focus on tackling corruption, one topic wey e don cover for im earlier career as a journalist, and reducing environmental destruction.
Last week, e say im and im don get threats from di leader of one gang linked to drug trafficking.
Oga Villavicencio, wey don marry wit five children, na one one of eight candidates wey dey contest for di first round of di election, although no be di frontrunner.
Im killing follow dat of Agustín Intriago, mayor of di city of Manta, for July and Omar Menéndez, candidate for mayor in di city of Puerto López, in February.
Paying tribute, Villavicencio party, Movimiento Construye, share comment wey e post for social media in response to calls to suspend di presidential campaign following Intriago death.
"Hiding in moments wen criminals assassinate citizens and officials na an act of cowardice," e bin write.
Former vice president and fellow candidate Otto Sonnenholzner send im "deepest condolences and deep solidarity" to Oga Villavicencio's family.
"May God keep am and im glory," e write. "Our kontri don go out of hand."
Frontrunner Luisa Gonzales also share her "solidarity" to Oga Villavicencio family, adding: "Dis wicked act no go go unpunished."
From union leader to journalist
Dem born Villavicencio for October 11, 1963 for Seville, Alausí canton, for di province of Chimborazo, for di center-south of di kontri.
According to di profile wey dem publish for im campaign website, e bin grow up for one rural environment wia e learn to "work and respect the land and to konnect wit di most humble."
Since e be teenager, dem link am to indigenous and worker social join-bodi.
According to di biography for im campaign website, for 1999 e be union leader for di Federation of Oil Workers (Fetrapec).
E study journalism and social communication for Universidad Cooperativa de Colombia.
As investigative journalist, e collaborate wit different Ecuadorian and international media outlets.
E also write 10 books.
Dem born Villavicencio for October 11, 1963 for Seville, Alausí canton, for di province of Chimborazo, for di center-south of di kontri.
According to di profile wey dem publish for im campaign website, e bin grow up for one rural environment wia e learn to "work and respect the land and to konnect wit di most humble."
Since e be teenager, dem link am to indigenous and worker social join-bodi.
According to di biography for im campaign website, for 1999 e be union leader for di Federation of Oil Workers (Fetrapec).
E study journalism and social communication for Universidad Cooperativa de Colombia.
As investigative journalist, e collaborate wit different Ecuadorian and international media outlets.
E also write 10 books.
For di Assembly, wey e bin land wit Alianza Honesty, wey be dat of di Concertación Movement and di Ecuadorian Socialist Party, Villavicencio bin head di Political Oversight and Control Commission.
During di impeachment trial against Lasso, pipo bin find fault wit am sake of say di commission bin give one report wey favour di president wey no get di support of oda legislators.
Villavicencio also direct di Anti-Corruption Parliamentary Front, from which e file some complaints and promote investigations into corruption issues for di oil field , wey match di years of presidencies of Rafael Correa, Lenín Moreno and Guillermo Lasso.
Di biggest political scandal wey e uncover under im leadership as assemblyman na di so-called Petrochina case , di debt wey Ecuador allegedly acquire wit China during di goment of Rafael Correa and wey Villavicencio denounce as corruption scheme.













