Wetin dey cause fight-fight for DR Congo?

Close up of hands wey hold five bullets

Wia dis foto come from, AFP

    • Author, Damian Zane
    • Role, BBC News
  • Read am in 5 mins

Di Democratic Republic of Congo wey full wit mineral resources for di east don dey inside serious kasala for ova 30 years since di 1994 Rwandan genocide.

Plenti armed groups don dey fight wit central authorities for power and control of di potential money wey fit flow from dis ogbonge nation.

Dis kasala don drag neighbouring kontris follow bodi and increase di effects. Most notable na di one for di 1990s wen two ogbonge kasala wey dem call Africa World Wars wey cause di deaths of millions of pipo happen.

Wetin dey happun now?

Afta rapid advance for di region, fighters from di M23 rebel group don enta Goma, wey be big city wey get more dan one million pipo inside for di east of DR Congo.

E dey for border wit Rwanda and for di shores of Lake Kivu wey make am important trading and transport hub wey dey within reach of di mining towns wey dey supply metals and minerals wey dey in high demand like gold, tin and coltan, wey be di koko of mobile phones and batteries wey dem dey use for electric vehicles.

Di rebels say na dem dey run tins now for di city but di Congolese goment say dia troops still dey hold some important locations.

Who be di M23?

Na di ethnic Tutsis dey lead di M23 wey say dem need to take arms so dem go fit protect di rights of di minority group.

Dem tok say plenti of di last deals wey dem don reach bin no dey respected. Dia name na from one peace agreement wey bin dey signed on 23 March 2009.

Soon afta M23 dey formed, for 2012, dem sharparly gain territory and gbab Goma. Sometin wey don come under international criticism and accusations of war crimes and human rights violation.

Dem bin dey forced to comot Goma and den suffer defeats for di hands of di Congolese army wey bin dey backed by multinational force. Dis comot dem from di kontri pata-pata.

M23 fighters come promise say dem go join di army in return for promises say di Tutsis go dey protected.

But for 2021, di group carry dia weapons again say dem break di promises.

Rwanda get hand for di fight-fight?

Neighbouring Rwanda don deny bifor say dem dey support di M23 but na since 2012, UN sabi pipo accuse dem say dem dey provide weapons, logistical support and even dey command di rebels.

DR Congo goment togeda wit di US and France don also torchlight Rwanda say dem dey back di group. Last year, one UN expert report tok say up to 4,000 Rwandan troops bin dey fight togeda wit di M23.

For statement on Sunday, Rwanda no tok clearly say dem no back M23. Instead, dem tok say di fight-fight near dia border na "serious threat" to dia "security and territorial integrity".

Den add say dem dey use Rwanda as scapegoat and dem dey get blame for di recent fight wit di Congolese authorities. Dem say dem no gree enta dialogue wit di M23.

Peace process wey Angola mediate and bin involve Rwanda and DR Congo bin cause ceasefire deal last year but dat one scata and fighting start again.

Wetin be di connection wit Rwanda?

Di origin for di current fight-fight fit dey partially linked back to di genocide wey happun for Rwanda for 1994.

About 800,000 pipo, most of dem from di Tutsi community bin dey killed by ethnic Hutu extremists.

Di genocide end as force of Tutsi rebels wey bin dey commanded by current president Paul Kagame bin advance.

As dem bin dey fear punishment, about one million Hutus run across di border enta wia dem dey now call DR Congo. Dis move make one marginalised Tutsi group for di east wey dem dey call di Banyamulenge to fall under threat.

Rwanda army don invade DR Congo twice say e dey pursue di pipo wey cause di genocide and bin work wit di Banyamulenge and oda armed groups.

Afta 30 years of fight-fight, one of di Hutu groups, di Democratic Forces for di Liberation of Rwanda (FDLR) wey include some of who dey responsible for di Rwandan genocide, still dey active for eastern DR Congo.,

Rwanda call di FDLR "genocidal militia" and say dia continued existence for di DR Congo east dey threaten dia own territory.

Dem accuse di Congolese authorities say dem dey work wit FDLR, wey DR COngo deny.

E no be like Rwanda go comot hand pata-pata from DR Congo until dem satisfy say FDLR no be threat to dem or di Tutsi communities wey dey eastern DR Congo.

But dem dey widely accused say dem dey use di kasala to chop money from di mineral wealth of DR Congo.

Peacekeepers dey di region so?

One UN peacekeeping mission don dey ground since 1999. Di current force – wey dem dey call Monusco – get ova 10,000 troops.

Dia mission get wetin dem dey call Force Intervention Brigade wey dey arrange offensive operations against specific groups.

Monusco soon become di target of vex from ordinary Congolese wey see dem as dem no dey do dia job well. President Félix Tshisekedi, wey judge di mission as failure, bin ask dem make dem comot by di end of last year.

But di departure bin dey delayed and for December, dem extend di mission for anoda year.

Di Southern African Development Community (Sadc), wey be regional grouping of 16 kontris, bin also deploy military force enta eastern DR Congo but dem no fit stop di rebel advance.

South Africa say dem kill five of dia sojas during clashes wit rebels.

Three Malawian sojas don also dey killed, according to wetin di UN tok as Uruguay army tok say one of dia sojas wey bin dey part of Monusco bin don die.

A map showing DR Congo and Rwanda