Edo state govnorship election final result

Edo election ballot box
Read am in 3 mins

Nigeria election join bodi di Independent National Election Commission (Inec), don collate and announce results for di afta di Edo state govnorship election of Saturday.

Sixteen men and one woman, 17 political parties na im contest for dis ogbonge position of govnor of Edo State.

Di gubernatorial election wey be one of di off-cycle elections for 2024, take place across di 18 local goment area for di state.

Di final step for di elections na di official announcement of election results by di electoral administrators.

Dis na how dem dey announce am for govnorship election according to Inec.

Di Presiding Officers go send results of di election to di RA Collation Officer.

RA Collation Officer go collate and send di result to di local government Collation Officer.

Di local government Collation Officer go collate di results and send to di State Returning Officer.

Di State Returning Officer go den collate di results from di LGA Collation Centres, and declare di result and return di winner as Governor elect for di state.

Candidate for di election to di office of Governor go dey declared winner if e get:

Di highest number of votes cast for di election; and

Not less dan one-quarter of all di votes cast in each of at least two-thirds of all di LGAs for di state.

Na afta all dis, di returning officer go declare di winner.

E fit take between one to three days depending.

For di last election for 19, September 2020, Inec declare di winner on 20, September 2020.

For dis year own wey happun on 21, September 2024, Inec declare di winner on Sunday 22, September.

Edo election final result

Move around di map to see who win which local government as Inec announce am