#EdoDecides2024: How Edo governorship election take waka

Ova 2.2 million pipo register to vote for who go be di next govnor of Edo State for southern Nigeria.

Summary

  • Vote counting don start for Edo state governorship election
  • Heavy security mount for INEC collation centre
  • Olumide Akpata lose for im polling unit
  • Afrobeats star Davido dey para for INEC
  • Whoever become govnor-elect go replace Godwin Obaseki for office on 11 November

Live Coverage

Helen Oyibo, Annette Arotiba, Victor Ezeama

  1. Edo state govnorship election final result

  2. Na hia we go match break!, We dey come back

    We don match break for our coverage of di Edo state governorship election.

    Thank you for following all our tori

    We go come back wen dem start to collate di result

    See you later!

  3. INEC IReV portal show as Edo governorship election results dey enta

    INEC

    Wia dis foto come from, INEC

    Di Independent National Electoral Commission don kontinu to upload results sheets from polling units inside di Edo State Governorship Election results portal, IReV.

    Di commission don begin upload di result sheets since counting of ballots start for polling units wia di voting process don end.

    E neva clear who dey lead among di three ogbonge candidates but di Inec so far don upload high percentage of di result sheets for dia results portal.

    Also, heavy security don mount for di Inec collation centre for Benin, di state capital ahead of di official announcement of result.

    Monitor Inec IReV portal here: https://www.inecelectionresults.ng/elections/latest

  4. Edo electoral commissioner assure voters say dia votes go count

    Edo state Inec resident electoral commissioner, Anugbum Onuoha siddon for frot of microphones

    Wia dis foto come from, Anugbum Onuoha Facebook

    Wetin we call dis foto, Edo state Inec resident electoral commissioner, Anugbum Onuoha

    Di Inec Resident electoral commissioner (REC) for Edo state Anugbum Onuoha don tell tori pipo say voters no need worry say dia vote go count.

    Onuoha tok dis one afta im assessment of di Edo Governorship election exercise.

    E add say even though rain fall, and some officials no quick reach dia polling units and minor issues di proccess dey generally commendable.

  5. Breaking, Asue Ighodalo win im polling unit

    Di PDP govnorship candidate for di election, Asue Ighodalo win im polling unit.

    E win Esan South East, Ward 1, Unit 3 Idiro.

    PDP- 200

    APC- 45

    LP - 0

    • Why Edo state Election na three-horse race
    Edo election result sheet

    Wia dis foto come from, Asue Ighodalo media unit

    Wetin we call dis foto, Result sheet for Esan South East, ward 1, Unit 3 Idiro
  6. INEC set up collation wia dem go announce result

    INEC collation centre for Edo

    Di Inec State collation center don begin setup for di arrival of results from di various local govment for Edo state.

    Different RAC centers don begin di collation of results from polling units.

    Meanwhile, within local goment areas like Oredo, Egor and Ikpoba Okha, voters quickly cast dia votes despite di heavy rain wey fall.

    Oredo wey be one of di local goments wey get number of registered voters pass for di state, plenty polling units quickly count dia ballot papers finish.

  7. Massive security dey for Inec collation centre

    Heavy security mount for INEC collation centre for Benin, di Edo state capital.

    Na for di collation centre dem go announce di results of di election.

    Our tori pesin see many security pipo including police, army and DSS.

    Inec neva tok wen dem go start to collate result for di election wey start since 7am dis morning.

    Police pipo
    Wetin we call dis foto, Foto of Police men wey dey guard Inec collation centre in Edo state
    Police pipo
    Wetin we call dis foto, Foto of Police men wey dey guard Inec collation centre in Edo state
    Police pipo
    Wetin we call dis foto, Foto of Police men wey dey guard Inec collation centre in Edo state
    Police pipo
    Wetin we call dis foto, Foto of Police men wey dey guard Inec collation centre in Edo state
    Police pipo
    Wetin we call dis foto, Foto of Police men wey dey guard Inec collation centre in Edo state
  8. Fotos of result sheet from different polling units

    Result sheet from polling unit for Edo state
    Wetin we call dis foto, Result sheet from polling unit for Edo state

    As counting of votes dey go on for Edo, fotos of result sheets don begin enta from different polling units.

    Result sheet from polling unit for Edo state
    Wetin we call dis foto, Result sheet from polling unit for Edo state
    Result sheet from polling unit for Edo state
    Wetin we call dis foto, Result sheet from polling unit for Edo state
    Result sheet from polling unit for Edo state
    Wetin we call dis foto, Result sheet from polling unit for Edo state
    Result sheet from polling unit for Edo state
    Wetin we call dis foto, Result sheet from polling unit for Edo state
    Result sheet from polling unit for Edo state
    Wetin we call dis foto, Result sheet from polling unit for Edo state
    Result sheet from polling unit for Edo state

    Wia dis foto come from, bb

    Wetin we call dis foto, Result sheet from polling unit for Edo state
  9. 'Edo pipo make una no sleep' Davido tell voters

    Davido

    Wia dis foto come from, AFP

    Nigeria musician David Adeleke wey dey popular as Davido dey beg Edo pipo to shine dia eyes as counting of votes don start.

    E encourage dem to push sleep go one side as im alleged say na for night mago-mago dey happun as e make reference to wetin happun for di govnorship election for Osun state.

    "Nah dat night dem dey always strike … for osun we no sleep three days .. I know how many back of head I slap dat day ..’wake up ooo sleep neva reach “.. Edo pple una need to dey vigilant till di very end… I mean VERY END !! e post on im X account

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  10. Olumide Akpata lose for im polling unit

    Result sheet
    Wetin we call dis foto, Result sheet

    Labour Party candidate for di Edo state governorship election Olumide Akpata don lose im polling unit.

    Result from im polling unit PU11, Ward 06, Oredo show say na PDP Asue Ighodalo win di unit.

    APC: 19

    LP: 32

    PDP: 41

  11. Vote counting don start for Edo state governorship election

    Some women dey dance as counting of ballot dey go on
    Wetin we call dis foto, Some women dey dance as counting of ballot dey go on

    Counting of ballots don begin for di Edo governorship election as Inec extend voting for some areas.

    Some party members dey celebrate di victory of dia candidates for Obaseki polling unit.

    Na for areas wey officials late to arrive wia authorities bin extend voting hours for polling units.

    Counting of votes don begin across poling units
    Wetin we call dis foto, Counting of votes don begin across poling units
  12. Unidentified thugs scata electoral process for polling unit for Uselu

    Dem spread wet ballot papers wey thugs throw way on top table

    Presiding Officer for Polling Unit 021, Ward 07 Uselu 01 run comot di polling unit afta unidentified thugs scata di voting process

    As di voting dey go on, some thugs bin storm di place, begin throw away ballot papers inside water.

    Di electoral officer for Egor local goment, Boma Bamson wey follow BBC Pidgin tok say if tins scatter, afta dem chook eye for di mata and confam, dem go cancel di election for di polling unit.

    Oga Bamson say Inec go investigate di mata wen dem see di presiding officer wey run comot for polling unit.

    Ballot papers inside water
  13. INEC extend voting time for areas wia voting start late

    Di Independent National Electoral Commission (Inec) don extend di time of voting for areas wia di process start late.

    Mohammed Haruna, Inec Information and Voter Education Committee announce di informate for inside statement di commission post on X.

    “To ensure say no voter dey disenfranchised, di commission wish to say, in line wit our regulations and guidelines, voting go dey extended wherever e start late and go continue until di last voter on di queue wey arrive di polling unit by 2:30pm don vote.” Di statement read.

    Di electoral body say dem don inform di Inec Edo state office to ensure to provide light and back-up electric generators for di affected polling units or ward collation centres.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  14. Fotos from moments wen di three top Edo gubernatorial candidates cast dia votes

    Edo PDP govnorship candidate Asue Ighodalo cast im vote

    Wia dis foto come from, Asue Ighodalo/Instagram

    Di Peoples Democratic Party (PDP) candidate for di Edo state govnorship election Asue Ighodalo cast im vote for Polling Unit 3 ward 1, Idiro Okaigben, Ewohimi, Esan South East LGA.

    For im Instagram account, e say im dey impressed wit di turnout of voters but INEC really need to step up dia game.

    “I believe strongly say di preparation for an off-cycle suppose dey beta to forestall some of di delays we witness today,” e tok.

    Govnorship candidate of di All Progressives Congress Monday Okpebholo cast im vote

    Wia dis foto come from, Monday Okpebholo/Facebook

    Govnorship candidate of di All Progressives Congress Monday Okpebholo cast im vote for im polling unit for Udomi primary school 1, Irrua.

    Olumide Akpata, Labour Party govnorship candidate

    While di Labour Party govnorship candidate, Olumide Akpata cast im vote for Polling Unit 011, Ward 06 New Benin, Oredo LGA.

    For Akpata, e say di electoral process dey smooth for am and e hope say na so e be for all Edo voters.

  15. PDP candidate Asue Ighodalo don cast im vote

    Asue Ighodalo

    Wia dis foto come from, X/Aighodalo

    Asue Ighodalo, di PDP candidate, don cast im vote.

    Even though di process start late for im polling unit due to di late arrival of election materials.

    E vote for Ward 1, PU 3, Ewohimi, Esan south-east LGA.

    Tori be say e vote around 12:00pm

  16. 'I dey happy to experience di process' - First time voter

    Nancy, first time voter stand for queue to cast her vote for di Edo gubernatorial election

    Nancy dey vote for di first time in her life.

    Di 22-year-old say she for vote for 2019 but she bin dey write di West African Senior School Certificate Examination dat year.

    She no tok why she dey vote, however she say she like di feeling of voting and she dey happy to experience di process.

    Electoral officer dey capture Nancy., first time voter face
  17. 80-year-old Bello Osagie vote for Edo gubernatorial election

    Bello Osagie, 8--year-old woman vote

    Madam Bello Osagie wey don pass 80-year-old say di situation of di kontri force her to come out to vote.

    “Di situation of dis kontri let many pipo down, everything don cost especially for Benin, no fuel, wia I dey go before for N500, now na N2,000.”

    She dey hope say make beta pesin wey get di interest of pipo for heart win di election.

  18. Breaking, Obaseki cast im vote

    Godwin Obaseki

    Edo state Govnor Godwin Obaseki don cast im vote.

    Obaseki cast im vote for im polling Unit 19, Ward 4, Oredo LGA.

    Di govnor say di process dey go peacefully and e dey expect good result.

  19. Edo voters cast ballot inside rain

    Pipo wey dey wait to cast dia vote for di Edo state govnorship election hold umbrella as rain dey fall

    Despite rainfall for some parts of Edo state, eligible voters still turn out for dia numbers to vote.

    Some voters hold umbrella and stand for dia polling units to wait to cast dia vote.

    Voters for Edo state dey vote to elect di next govnor wey go take ova from Godwin Obaseki wey don rule di state for eight years.

    Voters wey wan cast dia vote for di Edo state govnorship election hold umbrella as rain dey fall
    Voters queue for line as dem dey wait to cast dia vote for dia polling unit under di rain
  20. 'Di voting process dey seamless for me' - Olumide Akpata

    Labour party govnorship candidate Olumide Akpata dey follow tori pipo tok afta e cast im vote for polling unit 011, ward 06 New Benin, Oredo LGA

    More from di Labour Party govnorship candidate for di Edo state gubernatorial election Olumide Akpata afta im cast im vote.

    E say di voting process dey smooth for am and e hope dat go be di experience of all Edo voters.

    “I still dey try make my own conclusion but for my own process, e dey seamless, di machine work, dem capture me, my foto dey my ballot paper, I go vote. E go well for me and I hope dat go be di experience of every Edo voter but I no go conclude yet till we get feedback.”

    On di election, e say dem dey get some concerning feedback but im still dey try verify and observe till im make any statement.

    Oga Akpata also call on Inec to allow all party agents for di collation center, so dat all of dem go witness di electoral process and confam di credibility of di process.

    Labour Party govnorship candidate Olumide Akpata dey cast im vote for di Edo gubernatorial election
    Labour Party govnorship candidate Olumide Akpata dey cast im vote for di Edo gubernatorial election