How NDLEA seize largest heroin consignment for Lagos Airport, burst syndicate inside one '12 day' operation

Wia dis foto come from, NDLEA
Nigeria drug police say dem don seize wetin dem call di single largest heroin consignment for Murtala Muhammed International Airport, Ikeja, Lagos State, Nigeria.
Di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) wey announce dis informate during one press briefing for Lagos add say dem arrest members of di organised criminal network wey dey involved in trafficking heroin across multiple kontris wey include Nigeria, South Africa, Mozambique, Europe and America.
Di largest heroin wey dem recover weight a total 51.90 kilograms.
“Dem hide di illegal substance inside 15 cartons of 2300-watt metal cutting machines. Each carton dey stocked wit three blocks of high-grade heroin. In total, we recover 45 blocks of di illicit substance wit a total weight of 49.70kg.” Di anti-drug agency tok.
Oga Marwa say dem don arrest pipo wey dey connected wit di deal.

Wia dis foto come from, NDLEA/X
Di anti-drug agency say di operation wey lead to di seizure of di single largest consignment take dem 12 days.
Di NDLEA boss tok say from dia investigations, dem don identify di kingpin of di syndicate for Nigeria and im name na Reginald Peter Chidiebere.
“Dis syndicate get wide network for Nigeria because dem mark di consignments we seize wit plenty codenames, wey show say e belong to different members of dis organised criminal group.
End of Di one wey oda users dey read well well
“Furthermore, for our follow-up operation, we discover from di suspect a long list of receivers of di illicit drugs. In di end, we dey able to identify di kingpin of di syndicate for Nigeria and im name na Reginald Peter Chidiebere. Our investigations show say na im get Golden Platinum Hotel and Suite, wey dey 16 Reginald Peter Chidiebere Street, Hope Estate, Ago Palace.” E tok.
Oga Marwa add say dem also arrest four cartel members wey dey linked to di recent seizure.
Di Nigeria Drug police say dem don take some actions against members of di syndicate wey include freezing of accounts of di suspects and seizing of property.
“So far, we don take proactive actions against members of di syndicate wey include freezing a total of 107 bank accounts wey dey associated wit 14 members of di cartel as well as N119,582,928.31 we see for some of di already traced bank accounts.”

Wia dis foto come from, NDLEA/X










