Cameroon in shock as opposition figure die for detention

Cameroonian politician Anicet Ekane wear blackwit white strip shirt

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Wetin we call dis foto, Cameroonian politician Anicet Ekane, director of di African Movement for New Independence and Democracy (MANIDEM) political party, dey look for one press conference for Yaounde on July 19, 2025.
Read am in 5 mins

One firebrand Cameroonian opposition politician Anicet Ekane don die for detention.

Tori of im death dey come barely one-month afta im arrest, im lawyers and Manidem party announce.

E dey among di leaders of one opposition coalition wey endorse Issa Tchiroma Bakary for di October 12 presidential election. Oga Bakary bin claim say im defeat di incumbent President Paul Biya.

Authorities bin arrest some of di oppositions for di economic capital Douala and transfer dem go di capital Yaoundé.

One tok-tok pesin for di party tell BBC say Mr Ekane die dis morning for im hospital room for one military medical facility.

"We no get any clarification... Dem bin call im wife to come and wen she reach dia, dem just present her husband corpse give her," e tok.

E add say im family later carry di corpse go mortuary.

For one statement, di tok-tok pesin for di Ministry of Defence Capt. Cyrille Serge Atonfack tok say di 74-year-old bin die of illness.

"Dem don since keep di deceased wey bin suffer from various chronic pathologies for di Military Medical Centre of di National Gendarmerie," e tok, and add say doctors bin take good care of di politician since im arrest on October 24.

According to Anicet Ekane lawyers, dem accuse am of hostility against di state, incitement to revolt, and calls for insurrection.

"Dem no ever present am bifor a judge or charge am wit any crime," one of im lawyers Hippolyte Meli tok for statement on social media. E describe di detention of di Manidem party leader as illegal.

Oga Ekane death don send shockwaves across di nation, several supporters don gada for di party headquarters for Douala to grieve.

However, di party reveal say security forces don surround im house.

Anicet Ekane bin initially endorse anoda ogbonge opposition figure Maurice Kamto for di presidential election. But, di Electoral body, ELECAM, plus di Constitutional Council reject Kamto candidacy on di grounds say di party endorse more dan one candidate.

Mr. Ekane plus oda politicians bin go ahead to create di Union for Change Coalition wit oda politicians, wey choose di former govment spokesman Issa Tchiroma Bakary as dia candidate.

Interior Minister Paul Atanga Nji bin warn against any unilateral declaration of victory, as e threaten defaulters wit lawsuits.

Authorities say dem don launch investigation to determine di exact circumstances of Ekane death.

Cameroon govment mourn Anicet Ekane

Cameroon govment don express regret ova di death of firebrand opposition figure Anicet Ekane, wey die for detention.

For one statement, di Minister of Communication and govment tok-tok pesin, René Emmanuel Sadi, tok say di politician don already dey suffer from "various pathologies" bifor im arrest on 24 October and subsequent demise for one military hospital.

Although Sadi no mention di nature of di sickness wey later lead to di death of Mr Ekane, e however repeat wetin di Defence Ministry tok, say di African Movement for New Independence and Democracy (Manidem) party President, receive proper medical attention from both im personal doctors and for di military hospital wia e take dey receive treatment.

"On behalf of di Head of State and govment of di Republic, I hereby send our most sincere condolences to di family of di deceased, plus to di activists of di Manidem [party]," Sadi add.

Although, Ekane party bin attribute im death to "repression" wey wetin dem describe as "illegitimate" regime cause.

Di govment say dem don launch investigation to clarify "wit precision and objectivity," di cause of di 74-year-old politician death.

Dem also call for caution as worries dey say di incident fit spark tension for di kontri.

European Union, odas condemn Ekane death

Pipo from several quarters don react to di death of di Manidem party president since di tori break.

Di European Union tok say Anicet Ekane death "leave ogbonge void for Cameroon public debate."

Dem urge di authorities to ensure di safety and physical integrity of all political actors. Dem also call for di release of all di pipo wey dey for detention since di October 12 presidential poll.

Meanwhile, famous anti-corruption lawyer Akere Muna describe Ekane passing as "di extinguishing of a fierce and passionate flame" wey burn for democratic emancipation.

Muna, wey withdraw im candidacy for di presidential election tok for statement say Ekane bin inform am of im ill health for dia last conversation.

"Pesin go reason say basic humanity, di fundamental presumption of innocence, plus di undeniable evidence of im failing health go force im captors to release am give im family and di care of di medical experts wey sabi im condition," Muna regret.

Ekane Manidem party don tell supporters to remain serene and mobilised, underscoring di need for a "fair popular response."