Cameroon opposition leader Issa Tchiroma Bakary run go The Gambia for safety

Govment of The Gambia don confam say Issa Tchiroma Bakary, di Cameroon opposition leader wey bin claim victory for di October 12 presidential election, dey for dia kontri for im safety.
For one statement wey di kontri Ministry of Information release on Sunday, dem say oga Bakary arrive for di kontri on November 7.
Dis don end di plenty tory wey dey fly around about di whereabouts of Bakary wey be former govment tok-tok pesin but now, dey see imsef as di legitimate president ova im former oga, Paul Biya.
"We dey host am temporarily for The Gambia purely on humanitarian grounds in di spirit of African solidarity and to make sure say e dey safe as discussions dey continue to pursue a peaceful and diplomatic resolution to di post-electoral tensions for Cameroon," di statement tok.
The Gambian authorities tok say dem no go gree make dem use dia kontri as "base for subversive activity against any state."
Cameroon electoral authorities bin declare 92-year-old Paul Biya as di winner of di presidential election wit 54%, even though say allegations of fraud and electoral irregularities bin plenty.
However, Tchiroma Bakary wey bin work under Biya don tok say e no go gree for di current regime until dem recognise im "victory" for di election.
Im resistance tactics so far include street protests to ghost town operations to bring govment activities to a standstill.
Di 76-year-old politician last month bin reveal say soldiers wey dey loyal to am move am from im residence for Garoua for northern Cameroon, for im safety.
Since den, nobody know exactly wia e dey even though many pipo tok say e dey hide for some neighbouring kontris.
Meanwhile, di United Democratic Party (UDP) wey be di main opposition party for di kontri don fault di govment for hiding di details of oga Bakary arrival.
Di party say di way wey di govment dey handle di mata "raise serious questions about transparency, accountability, and respect for di Gambian pipo right to know di actions wey dia guvment dey take in dia name".
"Govment no suppose dey use solidarity as justification for secrecy or di erosion of democratic accountability," di UDP tok.
Dem also ask di authorities to clarify di nature and duration of oga Bakary stay, including di commitments wey di Gambian govment make to external states.
However, di UDP say dem support oga Bakary as dem tok say dem dey fully aware of how "despotism dey operate and wetin dissenters dey face."
Di Gambian govment say dem dey engage wit regional partners, including Nigeria, for a peaceful solution.
E neva dey clear how di guvment of Cameroon go react to dis situation, especially since di Interior Minister Paul Atanga Nji don repeatedly tok say Bakary go face trial as e take im hand declare imsef winner of di election and organise street protests wey e call "rebellion."
According to di govment, 16 pipo bin kpai for dat post-election violence across di kontri, but figures from oda organisations show say di number of deaths dey way higher.










