Manchester United 3- 1 Arsenal: How Rashford, Antony help Man United break Arsenal unbeaten start record

Bukayo Saka

Wia dis foto come from, Getty Images

Manchester United's £82m new boy Antony score for im first game and Marcus Rashford get two as Erik ten Hag's men end Arsenal's 100% start for di season at Old Trafford.

Di Brazilian open di scoring 10 minutes before half-time for di pulsating duel, and sweep one shot into di far corner.

Rashford claim di assist for dat and den, after Bukayo Saka don level on di hour, di England striker profit from two clinical United counter-attacks.

Bruno Fernandes get hand for both, splitting di Arsenal defence for Rashford's first, den sending Christian Eriksen clear as di Dane provide di striker with a tap-in.

Na Rashford's first Premier League double since December 2020, helping lift dem to fifth ontop di table.

Arsenal remain top. But, after dia ogbonge start to fi season, manager Mikel Arteta gats dey concerned dem easily whip im side, although di Gunners get better first-half with Gabriel Martinelli goal ruled out by VAR.

FULL TIME UPDATES

KICK-OFF

0' Di match don start.

Na di hosts wey get di one under way.

1' Interestingly, di two loudest voices for di Arsenal huddle before kick-off na Gabriel Jesus and Oleksandr Zinchenko - add say Premier League-winning experience don make a real difference to Mikel Arteta's side dis season.

2' Lively start from Manchester United as Diogo Dalot go on ogbonge run but Arsenal clear and Gabriel Jesus use muscles take Lisandro Martínez off di ball to win di Gunners a free-kick, just to di side of di hosts' box.

3' Chance to deliver hia for Arsenal...

5' Antony nip in ahead of im national team-mate Gabriel Martinelli and win one free-kick - first sight of those quick feet.

6' Gabriel Jesus na di centre forward come defensive midfielder at times for Arsenal - e rob Antony just outside di Gunners box and set off on marauding run, only to be tackled by Scott McTominay. United think dem score but di referee bring am back for head injury.

8' CLOSE!

First big chance and e fall to Christian Eriksen.

Antony look to dey go nowhere, but find Diogo Dalot wit one neat backheel and e pick out Eriksen at di back post.

Di Dane watch am on to im left boot, but volley wide.

GOAL - 1 Arsenal

Di swiftest of breaks from Arsenal and Gabriel Martinelli finish delightfully.

Bruno Fernandes dey furious, claiming say Christian Eriksen don foul for di build-up, and e fit get point...

Video Assistant Referee

Paul Tierney dey go to di monitor.

14' DISALLOWED GOAL

E chalk am off.

Cheers from di home fans at Old Trafford, frustration for Arsenal.

19' Di corner dey hooked all di way to di back stick and Gabriel Jesus no fit steer im header on target from a tricky angle.

22' Arsenal dey start to dey settle on di ball more after one lively start by United, though na di hosts who win am back and get am wide to Antony.

Di debutant cut in on im left and looks to bend one from distance... dat no dey ever trouble Aaron Ramsdale.

23' Manchester United look to unleash Marcus Rashford over di top but Aaron Ramsdale dey out of im box quickly to head away. Plenty of pace for dat United front three.

25' YELLOW CARD

Bukayo Saka dey cause Tyrell Malacia few problems, e knock am him off di ball and den going over for di box under pressure from Lisandro Martinez.

United look to break and Arsenal defender William Saliba dey booked for bring wey counter to sudden halt.

27' Bruno Fernandes dey on di ground as Arsenal continue dia attack around am, e take one nibble off Albert Sambi Lokonga - di United playmaker go get some treatment after Antony put di ball out for am.

30' Oooh. Good football from Arsenal, wey work am all di way from Aaron Ramsdale for di back, up di pitch and across to Gabriel Martinelli.

E try to beat Diogo Dalot and di ball almost deflect inside di near post. Pressure building from di visitors.

32' CLOSE

Manchester United dey pinned in dia own box at di moment.

Arsenal dey see almost all of di ball and again na Gabriel Martinelli arriving from di left for di back post, dis time pick out by one superb Martin Odegaard delivery.

Martinelli get one header on target but David de Gea palm am away.

36' GOALLLLLLLLLLL

Antony get im debut goal!

45+2' One from di training ground?

Dat need little more work - Arsenal get everyone forward and chance to deliver, but look to clip am down di right to Bukayo Saka instead and e run out of play.

HALF-TIME

One good first half of football at Old Trafford.

Arsenal mostly on top, but na Manchester United dey lead.

SECOND HALF

45' E don start again. Make una expect another fiery 45 minutes from Old Trafford.

47' Bruno Fernandes get im boot high to pinch di ball back for midfield, too high say Paul Tierney and Arsenal get di free-kick.

Dem move am swiftly to Oleksandr Zinchenko but no one dey di middle to get on im cutback.

48' Lovely feet from Gabriel Jesus but e try to take on one defender too many and United scramble clear.

50' Christian Eriksen float one diagonal pass towards Antony on di right but e peel away and no fit angle im run in time to keep am in play. Dat na di out ball for di hosts at di moment.

53' CLOSE

Two big chances for one matter of moments for di Gunners!

First Martin Odegaard no fit connect properly with Gabriel Jesus' pass across di box wen well placed, and den Bukayo Saka do superbly to pluck di ball out of di sky and fashion an opportunity for imsef.

E dey tight angle and e flash one strike right across goal and wide of di far post.

60' GOALLLLLLLL GOAL

Arsenal get dia reward for one spell of relentless pressure for dis second half and na Bukayo Saka who draw dem level.

Martin Odegaard slide one neat ball through to Gabriel Jesus and e dey taken off im toes by Diogo Dalot, but di ball fall to Saka inside di box and e calmly turn am home with im left foot.

66' GOALLLL

Arsenal Bruno Fernandes pick Marcus Rashford out wit one ogbonge through ball and Rashford put United back for front with one calm finish beyond di onrushing Aaron Ramsdale.

75' GOALLLLLL

Anoda devastating break from di hosts as Bruno Fernandes release Christian Eriksen, e stride through on goal and sees Marcus Rashford on im left for di middle, before sliding di ball across goal for di forward to tuck home.

81' YELLOW CARD

E no take Harry Maguire long to pick up one booking. E dey forced to bring down Gabriel Jesus after Casemiro loss di ball. Dangerous free-kick for Arsenal...

82' Granit Xhaka line am up, and thunders ogbonge effort straight into Casemiro in di wall.

83' And now United fit break. Xhaka slip, Fred pounce and almost put Cristiano Ronaldo in. Aaron Ramsdale dey out quickly to mop up.

86' Fabio Vieira hook one volley goalwards as di ball pop up for im path but na over di crossbar. Arsenal dey try to find one way back into di one. But dem dey run out of time.

90+4' Last chance for Arsenal as Eddie Nketiah try to get on to a ball over di top and Tyrell Malacia beat am to am. Fabio Vieira try im luck from distance but e dey too easy for David de Gea.

FULL-TIME

Arsenal's winning start don comes to an end, but dat na four victories on di bounce for Manchester United.

Line up- Man United

1 David de Gea, 12 T. Malacia, 6 L. Martínez, 19 R. Varane, 20 Diogo Dalot, 14 C. Eriksen, 39 S. McTominay39, 25 J. Sancho25, 8 Bruno Fernandes, 21 Antony, 10 M. Rashford

Line up- Arsenal

1 A. Ramsdale, 35 O. Zinchenko, 6 Gabriel Magalhães, 2 W. Saliba, 4 B. White, 34 G. Xhaka, 23 A. Lokonga, 11 Gabriel Martinelli, 8 M. Ødegaard, 7 B. Saka, 9 Gabriel Jesus