Kamaru Usman: 'Di Nigerian nightmare' lose im welterweight title to Leon Edwards for UFC 278

Wia dis foto come from, Getty Images
Leon Edwards don knock out Kamaru Usman to win di welterweight title at UFC 278 for Salt Lake City, Utah.
Behind on points for di fifth, Edwards, 30, land one ogbonge left high-kick to stun Nigeria's pound-for-pound number one fighter.
Kamaru defeat dey come hours after Usyk win Anthony Joshua on split decision to retain heavyweight titles, See how di fight waka.
Edwards becomes di first British champion since Michael Bisping for 2016 and only di second in history.
"You all doubt me, say I no fit do am. Look at me now," Edwards tok after di fight.
"I come from di trenches. Na like dis dem build me. Daem don doubt me my whole life but look at me now."
In beating Usman, Birmingham's Edwards avenge im defeat in 2015 and end di 35-year-old's 15-fight unbeaten streak for di UFC.
Jamaican-born Edwards, wey be big underdog wit bookmakers going into di bout, extend im winning streak to 10 following di defeat to Usman seven years ago.
End of Di one wey oda users dey read well well
Usman win di first fight by using im wrestling to control di majority of di contest - one tactic wey Edwards say open im eyes to weaknesses for im own grappling game.
Following dat bout Edwards work hard on im wrestling and di improvements wey e make show from di start of di rematch.
For di first round e trip Usman, becoming di first fighter for UFC history to complete a takedown on di Nigerian.
Usman respond strongly for di second and third round, pressuring Edwards wit flurries of strikes and controlling much of di contest with im grappling.
At di end of di round Edwards' corner loudly urge dia fighter to up im game and "get im hands moving".
Edwards start to dey show signs of fatigue for di fourth, with di relentless grappling from Usman, as di champion land one ogbonge takedown and continue to control di fight.
With Usman likely ahead on points going into di fifth Edwards need something wey dey special - and e get am.
Witt one feint e lure Usman's head to di side, before landing one clean left high-kick, leaving di Nigerian nightmare stunned on di canvas.
Edwards jump on di cage for celebration as e realise di enormity of wetin e don achieve.
UFC commentator Joe Rogan say di kick wey end di fight fit be di dey best wey e don for di UFC, with Edwards shocking Usman for di fifth while behind on points being arguably di sport's biggest ever upset.
How pipo react for social media
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post, 1
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post, 2










