Sylvester Dowen College video: Sylvester Oromoni death make Nigerians debate bullying

Hash tag #justiceforsylvester dey drive school bullying debate across Nigeria afta Dowen College student Sylvester Oromoni death.
Sake of di death of di 12-year-old boy, BBC Pidgin on Monday 6 December, 2021 ask audience on social media to tok weda boarding school still dey safe for pikin dem nowadays.
Anoda debate wey di matter generate na weda day-schooling alone fit stop bullying palava wey children dey go through.
Sylvester die on Tuesday, November 30 under circumstances wey no dey clear.
Dowen College Lekki Lagos claim say di boy bin play football sustain injuries.
But Sylvester parents say dia pikin tell dem before he die say na five students beat am sake of say dem wan force am join dia cult.
Sylvester Oromini death - Boarding and day school get dia own wahala?
While pipo say boarding school no dey safe for pikin dem, odas tok say boarding school and day school get their own wahala.
Some pipo believe say both school get dia own wahala but majority believe say na management dey determine school wey better.



Boarding school na 'hell' - Some argue
Many pipo wey attend boarding school bin share dia bad experience.
Udom Udochukwu Maryjane say she prefer day school sake of say she bin go through hell wen she dey junior secondary for boarding school.
She say di junior students wey report dia seniors to school authorities dey get double punishment wen dey return to dia hostel.
Umoke Destiny say im pikin no go ever attend boarding school sake of say na boarding school he go and he sabi di side effect.
Wetin go solve dis bullying palava?
Many pipo say parents go fit find out wetin dia pikin dey go through for school if dem dey close and communicate well with di kids.
Ifeyinwa Anigbogu Mbaekwe say make parents dey close with dia pikin and make dem dia friends.
"Make you check bad behaviour immediately, praise good behaviour, make you teach dem self-love and love for neighbours. Make you take time to study dem and understand dia personality, strengths and weaknesses. Make you teach dem human sympathy," Mbaekwe write.
Elizabeth Iweanoge say make parents open eyes and study dia pikin behaviour. She also tok say owners and heads of boarding school suppose to study wetin dey happen for di school environment.
"Parent-teacher association must dey run well sake of say e go help parents complain to di school authority wetin dia pikin no like.
"Di teacher suppose dey visit di hostels every time to know how every pikin dey, if senior dey punish or molest them. Di school go get guardian counsellor room where every child go report everything wey dey hapun to dem.
"Finally, parents go dey get time ask dia children questions about dia experience in school. Help give your pikin courage say no one go fit kill am, so that he no go hide anything from you. Justice na for Silvester, di young girl for Abuja school and others. RIP young hero," Iweanoge write on Facebook."
Like #justiceforsylvester #justicefordondavis and #deeperlifehighschool bin trend in 2020

Deborah Okezie, mother of one JSS 1 student of Deeper Life High School Uyo bin raise alarm say two boys for di school sexually abuse im pikin, Don Davis.
Di parents of di boy bin demand di sum of N100million compensation for di inhuman torture dia 11 years old son suffer for di school.
For January 2021, one juvenile court for Uyo start di trial of di two boys wey allegedly molest di junior student.
Di court charge dem alongside five oda officials of di school.
Dis officials na teachers and di school Principal wey school authorities don already suspend.
Signs wey show say dem fit dey bully your child
Anjula say bully signs dey include:
- Pikin fit dey vex or cry every time and you no fit place why.
- Your pikin dey withdraw and fit tell you all di time say dem wan stay for house.
- Or dem fit dey make excuse say dem no dey feel fine on school days. Even wen dem dey fine and full of energy for weekends.
"Wen e be like your pikin dey say or do anytin to avoid school, e dey important to check in wit dem," she tok.
She say di first step as a parent na to stay calm wen you notice pattern of withdrawal, or see say dem dey express anxiety.
Di next tin na to make sure say your pikin fit follow you tok about wetin dey happun to dem.
Wetin Parents/guardian fit do to protect dia pikin from bullies
Child Protection expert, Taiwo Akinlami follow BBC Pidgin tok say e get many things wey parents fit do to prevent dia pikin from bully or immediately dem get di report or see any sign say pesin don bully dia pikin for school.
Child protection system: Oga Taiwo say di first tin wey parents or guardian must do before dem even register dia pikin for any school na to ask if di school get written child protection system.
For inside dis policy, e go dey clear wetin schools dey do to protect every student. Also wetin dem go do if e get any reported or suspicious case of molestation.
Complain and demand action: If parents no gree see any child protection policy and dem don already register dia pikin for di school, di next line of action wen dia children complain of bully for school na to immediately take am up wit di school authority by complaining.
Di child protection expert wey also be lawyer tell BBC Pidgin say parents/guardian must demand for something to be done about am.
Pscycho social support: Afta reports of bullying, Oga Taiwo say parents must give dia pikin pscycho social support.
"You need counselling for your pikin, because bullying no dey leave pikin wia e meet am. You need to get your child, help."
Create working talking relationship wit your pikin. "Let your pikin know say you dey available to tok to and respond anytime," oga Taiwo tok. E say dis one go make di pikin dey confident to always tok.
Consider legal actions: E also say if any cases of bullying come up against your pikin and you don report am to school and dem no take any action, Taiwo say make parents/guardians consider taking legal action against all di pipo wey dey involved.
"Finally, e dey important for you to comot your child from di school, if dem no fit help you."
Oga Taiwo also say to prepare your child for di world today, e dey important for parents and guardians to build resilience in dia pikin, tell dem wetin to expect out dia and how to react.
Wetin schools management fit do to end bullying?
For interview wit BBC Pidgin, Nnena Okore wey be principal for one school for Lagos, for southwest Nigeria say e dey important for schools to put up policies against bullying.
She say di first tin be say schools must get policies wey parents go sign without fear say dia pikin no go get hand for any act of bullying or dem go face punishment
She also tok about standard protection policy wey goment go monitor for all school. Wetin dis mean say schools must get proper medical care to cater to any health need of any child.
According to her, "counselling department for schools also dey important. Madam Nnena say dis go allow students speak freely to dia counsellor, complain about any form of bullying and for those wey also dey bully oda students, di counsellors fit also do reform sessions wit dem.










