Yaoundé nightclub explosion: LIVS waitress tok how yi escape fire incident inside Cameroon high class quarters

Di nightclub where di fire hapun

Wia dis foto come from, Bongben Jisi

Wetin we call dis foto, Di nightclub where di fire hapun

One of de survivors for di explosion for nightclub for Yaoundé, Cameroon wey kill pipo say na by de grace of God say e survive.

16 pipo die, odas injure for inside explosion weh e happen for cultural complex, LIV's night club Yacuba for Bastos neighbourhood, high class quarter for inside Yaoundé.

For yi, de cause of de fire fit don komot from bad electricity connection.

According to yi, de fire start for ceiling and fain sotey we check say na some innovation and decoration.

Wen de ceiling e start fall for ground, na den dem realize say na fire, danger.

"Ah loss laik 10 colleagues, customers. Weti weh ah see pass me for explain. Ma hair catch fire, ah rub'am for wall and e quench. Ah waka onto pipo weh deh di burn but ah no fit explain how fire no burn me, sotey ah komot. Waitress for LIVS Nightclub

Tori be say families dey in tears, some still di call dia relative weh deh bi dey for nightclub, dis phone di ring but deh no di pick.

Di club wia di explosion hapun

Wia dis foto come from, Thierry Ngongang/Twitter

Fireworks cause am

According to Communication Minister, Rene Emmanuel Sadi, de source of de explosion na fireworks weh de di eva use inside de cultural complex.

Fire start for ceiling, den cause two explosions, pipo panic inside de night club and commotion start as pipo wan run out.

Officials don put de die-bodies for Military Hospital mortuary for Ekounou quarters.

One of de big loss for de nightclub accident na Dr Fanne Mahamat weh na director for Ministry of Public Health, and Public Health Emergency Centre bi dey wit e brother and friend and dey all die inside de fire.

Information from police na say two exists dey for underground but as all man bi de try for komot for de same taim some climb on-top odas, and magnetic doors too no fit open.

Di club wia di explosion hapun

Wia dis foto come from, Thierry Ngongang/Twitter

Eight pipo weh deh get wound di receive treatment for Yaoundé Central hospital.

When de explosion happen, Minister of Territorial Administration, Paul Atanga Nji, Communication Minister Rene Sadi go evaluate de situation.

Cameroon dey currently host di Africa Cup of Nations and Yaoundé na one of di cities dem dey play game for.

Cameroon di play Comoros for Olembe Stadiums on Monday, some kilometres for de explosion site

Some pipo bi first check say na terrorist attack as armed groups di fight for Northwest and Southwest regions.

Goment don open investigate for shine eye for de whole situation.