Iyabo Oko news - Yoruba actress Sidikat Odukanmi family say she never die

Wia dis foto come from, IYABO OKO
Di daughter of Nollywood Yoruba actress Sidikat Odukanmi wey pipo sabi as Iyabo Oko don come out to clarify di tori wey dey fly upandan say she don die.
According to di daughter Bisi Aisha, dem bin pronounce her dead but she move again.
"She move her hand three hours afta dem pronounce am dead", di actress daughter tok for social media post.
Tori about di death of di actress Iyabo Oko bin first fly ontop social media late Wednesday night.
Her pikin Bisi Aisha bin also post di informate say her mama don die, actress, Foluke Darmola bin also post about di death.
And many pipo don dey mourn Iyabo Oko death for social media.

Wia dis foto come from, Other
Iyabo Oko die?
From wetin BBC find out early Thursday morning, 6, January, Iyabo Oko still dey alive.
Actress Foluke Daramola bin tok say Iyabo Oko pikin wey announce di death don call her back say her mama still dey alive.
End of Di one wey oda users dey read well well
Her pikin Bisi Aisha bin also post for her handle say Iyabo Oko bin move hand three hours afta dem pronounce say she die. Anoda popular yoruba actress Toyin Adegbola, wey pipo sabi as Toyin Tomato also post for her social media handle say Iyabo Oko still dey alive.
Toyin Tomato bin post say "Iyabo Oko pikin call me say she bin move her hand and say doctor bin notice live for her body".
"Na dis same pikin bin first call say her mama don die . Abeg make we pray for her", she tok.

Wia dis foto come from, Instagram/@bisiaisha
Who be Iyabo Oko?
Dem born Iyabo Oko for November 1960 for Iwo land Osun state, southwest Nigeria.
She bin attend primary school for Iwo and later move to Port Harcourt wit her papa wey be soldier, na dia she bin start secondary school.Iyabo oko bin start to act wen she be teenager.
Sake of di love wey she get for acting, she run comot from house wen she dey secondary school to join one acting group wia her papa bin go drag her comot two times.She bin join acting wit her secondary school education and na dia she complete am.
She later become popular for her acting career afta she show for one Oga Bello movie wey di title bi "OKO"
Iyabo Oko papa don die den before im pikin go dey popular, na only her mama fit witness di time.
Di Nollywood actor dey act different role for movie and she don receive ogbonge awards from di profession.
Some Years ago, Iyabo Oko bin take break from acting afta Doctors bin diagnose am of stroke, she bin receive treatment from military hospital for Nigeria and hospital FOR obodo oyinbo.
Last year, tori of iyabo Oko death bin also go round before dem later tok say e no dey true.










