Harsh learning environment for primary school in oil-rich Rivers State Nigeria

Wia dis foto come from, Martha Okere Nkem/Nigeria Info FM PH
Di children put blocks ontop each oda to form a table, sit on di floor and place dia books on di blocks to write.
Di foto you dey look so na classroom for Community Primary School, inside one area wia oil and gas boku for southern Nigeria.
Na classroom wia primary school pikins alias pupils dey learn up till today despite di harsh condition,
For dis 21st year of di 21st century, some schools still dey lack desk, chairs and descent learning space for Nigeria.

Wia dis foto come from, Community Primary School in Rivers State: Damaged
One of such school na Community Primary School, Amaku Igbodo for Etche Rivers State, Nigeria Info FM Port Harcourt dey report.
Dis dey happun two years after di Rivers State Government declared free primary and secondary education.
Broken pieces of four inches block wey dem use to stand di buildings na im pupils convert to desks and chairs, according to di tori.

Wia dis foto come from, Martha Okere Nkem/Nigeria Info FM PH
Nigeria Info 92.3 FM reporter wey visit di school say di children also learn under very harsh conditions.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis na due to leaking roof and absence of windows and doors, according to di report.
Residents of di area express sadness at River State government and nd Universal Basic Education board failure to renovate dis school.

Wia dis foto come from, Martha Okere Nkem/Nigeria Info FM PH
Di school need good standard structure for learning classrooms plus put desks and chairs for di pupils.
Dem also tok say dem don write letters written to the state government has gone unanswered.
BBC Pidgin however find out say Etche Local Government Chairman dey constructing anoda block of classroom inside Igbodo Community.










