UK Travel list: Nigeria dey "Amber" zone for Britain new travel restriction

UK Travel list: Nigeria dey "Amber" zone for Britain new travel restriction

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, International travel

Nigeria dey part of UK new international travel list of kontris wey get "Amber" warning sign.

Di west African nation dey among one hundred and eighty three kontris wey dey di list.

Dis mean say anybody wey dey Britain no fit travel to Nigeria or any kontri inside dis category for holiday, party or relax.

E also get things wey anybody wey dey live for dis Amber kontris must do, ten days before dem land UK.

Di new international travel advisory dey come as UK wan resume international travel.

British goment confam say e fit begin dey resume small-small from May 17.

UK Transport Secretary Grant Shapps bin announce say goment don lift di "Stay in di UK" regulation.

Di announcement mean say pipo go fit begin travel abroad for relaxation and e no go dey illegal again.

Goment set up di new traffic light system, wey put some kontris on Red, Amber or Green list, to explain di new travel advisory rules.

UK Travel list: Nigeria dey "Amber" zone for Britain new travel restriction

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, International travel

Twelve kontris na im dey di green travel list for England pipo.

E mean say anybody wey dey land England from dis kontris no go need to quarantine from 17 May, 2021.

Di biggest group na di amber list wey include Nigeria and oda popular European destinations like Spain, Italy and France.

Pipo wey dey come from dis kontris must stay for seperate room alias isolate for at least five days.

But oga Shapps say for now make nobody travel go those destinations.

Graphic showing how the traffic light system for arrivals will work

Di transport secretary say dis na first step to open up travel.

E add say em dey careful make coronavirus pandemic no go begin spread again.

E add say di "success of combating covid for di UK no be di same in many places abroad.

"We must make sure say di kontris we dey reconnect wit dey safe," oga Shapps tok.

Wetin you need to know before you travel go UK

  • You must complete di passenger locator form
  • You must take Covid- 19 test.
  • You go don book and pay for day 2 and day 8 coronavirus travel test.
  • When you land UK, you go quarantine for 10 days.
  • Do di test wey you don book for on di 2nd and 8th day afta you land di kontri.
UK Travel list: Nigeria dey "Amber" zone for Britain new travel restriction

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, A man dey look as di sunset for Portugal

Di full list of 12 kontis and territories wey pipo for England fit travel to without getting to isolate upon return include:

Portugal

Israel

Singapore

Australia

New Zealand

Brunei

Iceland

Gibraltar

Falkland Islands

Faroe Islands

South Georgia and the South Sandwich Islands

St Helena, Tristan de Cunha, Ascension Island