Banky W and Adesua baby Zaiah: Banky Wellington and Adesua Etomi, Nigerian musician and actor announce news of dia new born son

Adesua Wellington

Wia dis foto come from, @bankywellington

Read am in 1 mins

Nigeria musician and actor Banky Wellington AKA Banky W and im wife Adesua Etomi don announce say dem be new parents.

Di ogbonge couple make di announcement with pictures ontop dia Instagram page on Monday.

For her post, Adesua say:

"You get track record of keeping your word. Ọlọrun agbaye o, you are mighty".

"4 weeks ago I receive di best birthday gift ever. Our Son."

Skip Instagram post, 1
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post, 1

Meanwhile, Banky W also post ontop im Instagram page to wish im wife happy birthday and congratulate her for dia pikin.

Im say:

"Happy birthday to my lady, my love and Purpose Partner,

My world, my wife and Baby Mama.

I bin no think say e dey possible for you to be more beautiful dan you dey already... but I dey wrong.

Because you no just beautiful, you dey strong. " E tok.

"E turn our tears into triumph, and our loss into laughter

E don change our lives forever, here is to di next (and best) chapter" E tok.

Skip Instagram post, 2
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post, 2

Banky W and Adesua Etomi na ogbonge couple wey popular for di entertainment scene.

Dia marriage for 2017, top headlines.