Ghana presidential election results: ''No candidate secure more than 50 percent in 2020 Ghana Presidential Election''

Wia dis foto come from, Getty Images
Ghana opposition leader John Mahama say per de data wey dem collect, no candidate secure over 50 percent of valid votes cast in de 2020 Presidential elections.
De NDC file petition challenging results of de 2020 elections Wednesday afternoon
As part of de reliefs wey he dey seek for de Supreme Court, he explain say "based on de data contained in de declaration wey Mrs. Jean Adukwei Mensah declar, no candidate satisfy de requirement of Article 63(3) of de 1992 Constitution to be declared President-elect."
Per de 1992 Constitution "A person no fit be elected as President of Ghana unless at de presidential election de number of votes cast in en favour be more than fifty per cent of de total number of valid votes cast at de election."
Based on dis claim say no candidate get over 50 percent of votes, de petitioner, John Mahama dey petition de Supreme Court of Ghana to declare say de results wey EC Boss Jean Mensah announce be "unconstitutional, null den void."

Opposition NDC reject de 2020 Presidential Election results which Mahama describe as "fictional" and "flawed''
After dem hold series of nationwide protests calling on de Electoral Commission (EC) to reverse de decision in favour of de party, minority NDC members also storm EC office to submit petition on some parliamentary results but dem no fit do that as police block dem from entering EC offices.
End of Di one wey oda users dey read well well
Ghana Police after weeks of protest go court den secure ban on all NDC protests for Accra.
After all these developments wey emerge after de 2020 elections, de NDC put together dema finest legal brains who go lead de party in court with hopes say Supreme Court go reverse de election results.

Mahama petition Supreme Court of Ghana to order EC to conduct second election
Lawyers for Ghana's opposition leader, John Mahama petition Supreme Court of de land say made dem order Electoral Commission to conduct second election between NDC and NPP.
Dis be one of de reliefs John Mahama dey seek from de Supreme Court after dem file petition.
Ghana Electoral laws dey allow political parties to challenge election results den stuff within 21 days after de declaration of results, de NDC dey take dis course on de last day which be today.










