Ginimbi burial: Genius Kadungure family bury socialite for im hometown Domboshava

Ginimbi burial

Dem don bury popular Zimbabwe socialite and businessman Genius Kadungure aka Ginimbi wey die on Sunday, 8 November 2020 for accident wit three friends for e Domboshava mansion.

Ginimbi funeral arrangement bin start wit procession for Harare central business district (CBD) and a night-long all-white gala on di eve, e attract sizeable number of Zimbabwe's who is who.

Notable among di guests for di lavish funeral proceeding for Domboshava na former Dynamos Football Club chairman Kenny Mubaiwa and e daughter Mary wey be former wife to Zimbabwe Vice President Constantino Chiwenga.

Kenny Mubaiwa na uncle to Ginimbi from di mother side.

Also present, na Norton legislator Temba Mliswa, former legislator Beater Nyampinga and Ginimbi legion of friends wey include Pokello, Remo, Kitsi, Zodwa (former wife) and Wanisayi Mutandwa popularly known as Mawhindo among others.

Ginimbi burial
Wetin we call dis foto, Thousands of pipo attend in Burial for im hometown for Domboshava

Villagers from all walks of life for Domboshava also come in their numbers wearing white clothes and some even walk for many kilometres to reach di place of di funeral.

Although di chairs for di VIP section for di funeral bin dey all white, only few of Ginimbi friends and relatives bin wear white clothes, majority wear black T-Shirts.

During speech time, Ginimbi elder sister Juliet tell mourners say her brother bin get anointing of working hard even from a younger age.

"Wen e bin dey young im go grow vegetables and take dem to di market, or our father would go and sell on e behalf, I dey try tok say dem born Genius wit anointing of working hard.

"Genius bin dey naughty at times e go steal grain from home and sell to pipo, each time our father no dey house, im go take grain go sell.

"Im bin dey so creative, if you look for di gas industry, I tink e be di first black pesin wey start to sell gas for Zimbabwe, e bin dey work hard even though e fail im Ordinary Level education, e only pass agriculture," she tok.

Although Ginimbi dey regarded as one of di most successful young business pesin for Zimbabwe, many known Zimbabwean business pipo shun e funeral for e friends to take all di glory.

Even politicians from Zanu PF and MDC Alliance bin also dey absent and dem no send representatives.

Ginimbi burial

Despite building mansion, buying expensive cars and partying every day, Ginimbi no invest in funeral policy. However, all e funeral services come for free courtesy of Doves Morgan Funeral Company.

Other funeral companies also contribute money, mobile toilets and other tents.

Who be Ginimbi

Kadungure, or Ginimbi as e dey popularly known for social circles rise to fame courtesy of selling cooking gas (Pioneer Gas), before e venture into other businesses wey include trucks and entertainment (Dreams Night Club).

E love for luxury tins wey see am build mansion and acquire top of di range vehicles such as Range Rovers, Lamborghinis, Ferraris and Rolls Royce among others, ma pipo begin link e wealth to juju and drugs.

However, several of e friends don dismiss di juju theory.

Meanwhile, families of di other pipo wey die for di accident (Limumba Karim and Michelle Amuli) also attend di funeral and reveal say dem dey wait for DNA tests for their late relatives wey burn beyond recognition.