Ekow Hayford Dead: Suspected robbers shoot Ghana MP on his return from election campaign

Wia dis foto come from, Citinewsroom
Ghanaian Member of Parliament (MP) for Mfantseman Constituency, Ekow Quansah Hayford die after gunmen shoot am.
Six gunmen according to eye witness attack dem while dem dey return from campaign around 1.00am, Friday.
Eye witness wey speak to Accra-based JoyNews explain say de men try rob dem on de Abeadze Dominase - Abeadze Duadzi - Mankessim Road, in de process of de robbery de late Ekow Quansah identify himself as lawmaker.
De robbers after discovering say he be Member of Parliament accuse am for de problems in Ghana wey dem shoot am.
Dem deposit de remains of de late MP for Saltpond municipal hospital.
Ghana Police start dey investigate de murder of de lawmaker wey die in de early hours of Friday.
Central Regional Police PRO, DSP Irene Oppong say dem get filla say robbery Dey go on for de highway top so den go de scene
"We also get info say MP for Mfantseman be victim...we go fit confirm say only de MP wey die, en body dey morgue now" she reveal.
End of Di one wey oda users dey read well well
Police dey call on general public to help police plus information on de robbery case so say dem got arrested de culprits.
Hundreds of sympathizers full ground for de house of de late MP where en wife and two children Dey stay.
Who be MP Ekow Hayford?
De late Ekow Hayford lef behind en wife den two children.
Ekow Hayford enter parliament in 2016, en party New Patriotic Party give am de nod to represent dem again in de 2020 parliamentary elections.
He start en career plus de Ghana Police Service from 1993 to 1998 where he become Corporal(Cpl).
Mr Hayford later resign to pursue private business until he enter parliament on de ticket of de New Patriotic Party.










