Coronavirus: AstraZeneca Oxford University Covid-19 vaccine trial dey on pause - See why experts match break

Wia dis foto come from, Reuters
Dem don gbab break for di final clinical trials for one coronavirus vaccine wey AstraZeneca and Oxford University dey develop
Dem suspend di trial afta one participant get very serious reaction inside United Kingdom and AstraZeneca describe di suspension as "routine" pause for di case of "one unexplained illness".
Stat News, di health website wey first break di tori, tok say details of di UK participant serious reaction no dey immediately known, but quote one source wey say dem dey expect am to recover.
Di AstraZeneca-Oxford University vaccine na wetin pipo see as strong contender among dozens of odas wey dem dey develop world wide.
Scientist and authorities all ova di world dey closely monitor di outcome of di vaccine trials
Hopes bin don dey high on top say di vaccine fit be one of di first to come for market, afta successful phase 1 and 2 testing.
E move to Phase 3 testing in recent weeks and involve about 30,000 participants for US plus UK, Brazil and South Africa. Phase 3 trials for vaccines dey often involve thousands of participants and can last several years.
Dis na actually di second time e dey happen with di Oxford University/AstraZeneca coronavirus vaccine trial since dem immunise di first volunteers for April.
End of Di one wey oda users dey read well well
One Oxford University tok-tok pesin say: "For large trials, illnesses dey happen by chance but must be independently review to check dis carefully."
Di medical regulator- the MHRA go take di final decision on restarting di trial, e fit take only days. But until then all international vaccination sites, for UK, Brazil, South Africa and USA dey on hold.
Oxford University team believe dis process show say dem dey committed to di safety of dia volunteers and di highest standards of conduct for dia studies.
How far di world don go for di search for coronavirus vaccine?

Wia dis foto come from, Reuters
US President Donald Trump say im want make coronavirus vaccine dey available inside di kontri before 3 November's election, but im comments don raise fears say im dey put politics before safety.
On Tuesday, one group of nine Covid-19 vaccine developers try to assure pipo for public by announcing one "historic pledge" to follow scientific and ethical standards for di search for a vaccine.
AstraZeneca dey among di nine firms wey sign up to di pledge to only apply for regulatory approval afta vaccines don go through three phases of clinical study.
Industry giants Johnson & Johnson, BioNTech, GlaxoSmithKline, Pfizer, Merk, Moderna, Sanofi and Novavax na di oda signatories.
All of dem pledged to "always make di safety and well-being of pipo wey dem wan vaccinate dia top priority".
World Health Organization (WHO) say nearly 180 vaccine candidates na im don dey tested around di world but none don complete clinical trials yet.
Di organisation say dem no dey expect a vaccine to meet dia efficacy and safety guidelines before dem approve am dis year because of di time e dey take to test dem safely.













